obodo oyinbo

Iran Drag US Over World Cup Ticket Wahala

todayJune 9, 2026 6

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Iran Football Federation don accuse United States say dem withdraw di World Cup tickets wey belong to Iranian fans just few days before di 2026 tournament start.

Di federation say FIFA rules give every participating country 8 percent of match tickets, but dem suddenly collect Iran own allocation back after fans don already buy tickets and make travel plans.

Dem also complain say visa wahala don stop about 15 officials from entering America, adding to di tension between both countries.
Iran don call on FIFA and tournament organisers to make sure fairness and equal treatment dey for all teams and supporters.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds