Baba Presido of America, Donald Trump drop one or two on Tuesday say hand go touch Iran, say e nor get wetin person go tell am, hand go touch Iran say dem get mind shoot down one US military helicopter wey dey patrol near Strait of Hormuz.
Trump tuk for im truth social on Tuesday say, im hear report say di attack hapun for night, even as dem dey try find way to end di war.
For Iran side, parliament tuk tuk, Mohammad Bagher Ghalibaf warn US make dem nor try nonsense oh.
Dis mata hapun one day after Iran and Israel agree temporary peace.