OBODO NAIJA

Akpabio Open National Assembly Door For Four New Senators

todayJune 24, 2026 3

Background
share close

By: Emmanuel Ariyo-David

Senate Presido Godswill Akpabio on Wednesday swear in four new senators wey win di recent bye-elections wey INEC conduct.

Di lawmakers na Olaka Nwogu of PDP for Rivers South-East, Envulu Anza of APC for Nasarawa North, Ikeje Asogwu of APC for Enugu North and Dayo Faduyile of APC for Ondo South.

Dem enter Senate after last Saturday bye-elections wey happen to fill vacant seats for di four senatorial districts.

Some of di seats become vacant after di death of former senators, while Ondo South seat open after former senator Jimoh Ibrahim become Nigeria Permanent Representative to di United Nations.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds