By : Jolayemi Olajide
Nor drive wawa, wawa, pipo nor dey hear for di obodo lagos oh, like dis now Lagos state Traffic pipo, don konfam one serious motor askident wey hapun for Monday morning inside Gbagada along di express.
According to LASTMA, di askident involve two big trucks wey carry cargo and one private car, gbowayi, dem jam demselves.
Di agency say emergency responders and tow truck don reach di scene and recovery operation don start to clear di road.
LASTMA sha dey advise motorists make dem nor drive wawawa and expect traffic as officials dey work to restore free movement.