obodo oyinbo

US And Iran Exchange Bomb scarra strait of Hormuz

todayJuly 9, 2026 8

Background
share close

By Oluwatosin Ibrahim

America and Iran don share some goodies, bomb  diaself for di second day straight on Thursday scarra  di Strait of Hormuz.

U sabi say, US Presido, Donald Trump, bin complain on Wednesday, say Iran nor dey hear English, dat when dem ready tuk peace, dem go calm down.

According to di US military, dem hit about 90 military targets, including di store wey Iran dey keep dia missile and drone, makachukwu, Iran don finish na

Iran sef no waste time, as dem sharpaly wrap bomb inside bitter leaf,  giv US military base for Arifjan and Ali Al Salem inside Kuwait, as well as Juffair and Sheikh Isa inside Bahrain.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds