Lagos

 Lagos PDP Deny Tinubu 2027 Endorsement

todayJuly 21, 2026 5

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Lagos State chapter of Peoples Democratic Party, PDP, don deny report wey claim say di party don endorse Presido Bola Tinubu and im administration ahead of di 2027 general election.

Di party tok dis one for statement wey im Publicity Secretary, Christopher Odianarewo, release on Tuesday, saying di report na false and Nigerians make dem ignore am.

According to PDP, Presido Tinubu no be member of di party, and dem never support am, im government or di policies of All Progressives Congress, APC.

Di Lagos PDP also tok say di statement wey dey circulate no get author, party logo, signature or approval from any recognised party organ, adding say dem still recognise di Interim National Working Committee led by Dr. Tanimu Turaki and di Board of Trustees under Senator Adolphus Wabara.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds