By : Jolayemi Olajide
ADC presidential candidate and former Vice Presido Atiku Abubakar don hit back at former Presido Olusegun Obasanjo, tok say after Obasanjo regain freedom from prison with little to im name, na him receive am, cloth am, care for am and make sure say e no lack anything.
Atiku, through statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release, tok say e react with sadness after Obasanjo recently describe choosing am as vice president as di biggest regret of im life.
Di former Vice Presido insist say Obasanjo latest attack dey connected to bitterness over di failure of im third-term agenda, adding say e support Obasanjo family during prison years, work with other patriots for im release and help build di political alliance wey later produce im presidency.
Di exchange don deepen di political war between di two former allies as Obasanjo own statement and Atiku response continue to generate fresh reactions across Nigeria.