US Presido Donald Trump on Monday don threaten to bomb Oman if di country try block any US deal with Iran over Strait of Hormuz, as e also tell Iran make dem surrender.
Iran and Oman officials don dey hold talks for weeks on how ships go take pass through di important waterway, and Iran Foreign Ministry say both sides dey work on joint agreement.
But Trump still dey insist say US get control of Strait of Hormuz, even as Iran effectively block di route since di Middle East war start on February 28, causing ship movement for di area to drop.
On Friday, Trump even threaten say e go declare Strait of Hormuz part of US territory and Iran fire back say di important waterway wey e don block go remain Iranian.
Read similar stories for here:https://konfamfm.com/iran-drag-trump-say-na-dem-dey-control-hormuz/