OBODO NAIJA

Naija Begin Send Onion Give Ghana

todayAugust 19, 2026 10

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Nigeria don lift suspension on onion exports to Ghana, clearing di way for immediate resumption of cross-border onion trade between both country.

Di National Onion Producer, Processor and Marketer Association of Nigeria say di decision follow consultation with trade pipo, diplomatic authority, ECOWAS and other stakeholder.

NOPPMAN President, Alhaji Aliyu Isah Maitasamu, na im announce di decision for public notice dated August 19, 2026.

Di association say dem suspend di export earlier because of problem wey Nigerian and Nigerien traders dey face over reception, allocation and offloading of onion consignments for Kotoku Market.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds