By: Mariam Ajayi
Primate Elijah Ayodele, Popular cleric don predict say Oga Presido Bola Tinubu fit move capital of Naija from Abuja go Lagos if e win di 2027 presidential election.
Di cleric make di prediction for one video for X as Tinubu dey prepare to get anoda term for office.
Ayodele say if Tinubu win again, Lagos architecture go change and di capital fit move to Epe, Lekki or any other part of di state.
But for now, di claim na only prediction from di cleric, as Abuja still remain Nigeria capital and government never announce any plan to move am.