Di Lagos State Police command don gbab one suspected cultist, 36-year-old Muyideen Olatunbosun, during anti-crime patrol for Idi-Iroko, Ogolonto and Agric area of Ikorodu.
Police gbab am as dem dey do patrol for that side, collobi better informate on top some doings, kon stop and search di suspect body, na so dem see one rubber-made pistol, one axe, criminal charms and one hard drug wey dem call “Ice”.
Di suspect dey police custody now, as he dey hellep dem with investigation, while police still dey find other members of di cult group wey dem suspect say e belong to.
Lagos State Commissioner of Police, CP Tijani Fatai, kon praise di officers for dia quick action and tell members of di public make dem continue to give police useful informate on top badness wey dey sup.