obodo oyinbo

US Strike Kpai 18 People For Iran, As War Tension Rise Again

todaySeptember 25, 2026 4

Background
share close

By: Mariam Ajayi

US strike for Iran don kpai 18 pipo and wunjure 108 others, according to Iran Health Minister.

Iran organisation wey dey helep pipo for emergency, war, natural disaster and other serious situations. Society say four pipo kpai and 67 others wunjure when one of di attacks hit wedding ceremony near di coast of Strait of Hormuz.

Kuwait military also report missile and drone attacks early Thursday, while US Presido Donald Trump threaten more military action against Iran even as opposition to di war dey grow for America.

Di fresh fight don raise fear say di war fit enter other countries, as Iran launch missiles and drones towards wetin e describe as US targets for Bahrain, Jordan, Kuwait and Iraq.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds