One pesin don kpai inside building collapse for Lagos, oda victim don kpeme, as dis-one collapse for Adedoyin Street, Ijegun, Ikotun area of Alimosho.
Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) naim dey konfamate dis update inside statement wey dem wrap like moimoi on Monday.
Say dem receive di call around 1:44 pm before dem send dia Igando Beta Team go de scene.
When di rescue team reach di place, dem discover say workers dey manually pull di building down before di structure come collapse on dem.
LASEMA tok tok, Olufemi Damilola, explain say one worker dey trap under di heavy building scata scata until hin kpai, while another worker sustain wunjury for hand.