Omo finally e don hapun, Iran don come out declare say countries inside di middle east fit handle dia problem alone without America.
Di seniorman Iran presido, Masoud Pezeshkian naim dey fry dis mata for one two aside meeting with Russia presido, Vladimir Putin.
Masoud clear Putin say all dis one wey America dey jump enter pipu country, say na over sabi doings and dat middle east country fit handle dia own wahala.