OBODO NAIJA

Police Drag Ear Give Pipo For AI Fake News Before 2027 Election

todayNovember 11, 2026 7

Background
share close

Police don warn say dem no go allow pipo use AI make fake videos, pictures and voices to deceive others before 2027 election.

Assistant Commissioner of Police, Bashir Abdullahi, tok dis one on Wednesday, November 11, 2026, for an online meeting about AI fake news and 2027 election.

He tok on behalf of di Inspector-General of Police Olatunji Rilwan Disu , He say police don set up National Cybercrime Centre after di 2023 election to find and torchlight fake things wey pipo dey spread online.

Abdullahi say police don join body with big social media companies to trace pipo wey dey spread lie lie news and find where dem dey post am from.

He say dem don already record cases of fake videos, including one wey show Presido Bola Ahmed Tinubu as if e tok wetin e never tok.

He say police get teams wey dey check such cases and dem go gbab anybody wey dem find behind di false news.

 

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds