Article

Must Read: Shey Di 2027 General Election Go Dey Safe?

todayNovember 13, 2026 16

Background
share close

Thugs Attack Peter Obi NDC Supporters For Lagos Ahead of Di 2027 Election

Tension don dey rise as Nigeria dey prepare for di 2027 general election, after another attack on members and supporters of Nigeria Democratic Congress (NDC) inside one political gathering for Lagos State.

Di attack happen on Thursday, November 12, 2026, for Classique Event Centre, Oregun, Ikeja, where party supporters gather for town hall meeting wey dem organise for di party presidential candidate, Peter Obi, and im running mate, Rabiu Kwankwaso, ahead of di 2027 general election.

Wetin make dis gbege to put fear for pipu mind be say, e happun for time wey be say different reports don record attacks on opposition politicians, campaign activities and supporters for different parts of Nigeria dis November.

 

Wetin Happen For Di Attack?

Di incident happun around 11 a.m. as NDC supporters dey enter di venue before dia town hall meeting go start.

According to eyewitness accounts wey TheCable report, one group of suspected political thugs near di venue through Kudirat Abiola Road, carry cutlasses, cudgels and stones for hand.

Di attackers reportedly try force demself enter di main hall, but NDC supporters first resist dem. Before you know am, everywhere scatter, as participants and tori pipu begin japa, left, right and center for safety.

Videos wey dey circulate online show pipu wey dey carry sticks, chairs and other objects as dem dey attack one another. Dem even spoil some motor dem as dem dey scatter everywhere.

One multimedia tori pesin with TheCable, Samuel Adebanjo, reportedly suffer attack from about six of di attackers wey dey ask am for him camera equipment.

Di attackers beat and kick am, while one of dem reportedly use axe knack im wrist, kon later carry im camera, gimbal and microphone comot.

Di kasala spread reach Kudirat Abiola Way, cause traffic for road and stop motorists together with pedestrians movement.

NDC supporters later catch one man wey dem suspect say e dey involved for di attack.

For one video wey News Central publish, di man claim say e nor come there to attack dem say na money e go beg for di venue, and deny say e participate for di attack.

Despite di fact say everywhere spoil, Peter Obi sti come di venue to continue with di town hall meeting.

 

How Many Times Dis Kind Attack Don Happen Dis Month?Di Lagos attack nor be di only reported attack wey involve NDC supporters and Peter Obi political activities dis November.

Reports don record at least four separate attacks or violent disruptions within di first 12 days of November 2026.

Di incidents include:

November 4, Calabar, Cross River State:

Peter Obi motorcade reportedly dey under attack around Watt Market by suspected hoodlums wey carry stones, bottles and other dangerous objects as e dey return from one political engagement.

Di police later announce say dem arrest one 27-year-old suspect, Victor Edet Yellow Duke, on top di matter.

November 7, Asaba, Delta State:

One rally wey Obidient/OK Movement organise to support Obi presidential ambition reportedly turn violent.

According to Delta State Police Command, one pesin kpai while five other pipu sustain wunjury inside di gbege.

 

November 11, Okpai, Delta State:

NDC supporters reportedly face attack for one campaign mobilisation exercise for di community. And five members sustain wunjury,

 

November 12, Oregun, Lagos State:

Suspected jaguda boys attack NDC supporters as dem prepare for di party town hall meeting.

Dem spoil motor, attack participants and sti assault one tori pesin.

All dis gbege dey give signal say security challenge dey for inside anything wey concern NDC as dem don face a lot within di first 12 days of November 2026.

 

Which Political Parties Dey Involved?Di two political parties wey dey front seat on top dis controversy na Nigeria Democratic Congress (NDC) and di ruling All Progressives Congress (APC).

NDC accuse APC say dem dey encourage political violence and dem dey try to intimidate opposition supporters as di country dey prepare for di 2027 general election.

Di party National Publicity Secretary, Osa Director, describe di attack as “unfortunate and unwarranted”. and e accuse di ruling party (APC) say dem dey do “Barbaric Politics”

Di tok tok pesin for NDC Campaign Council, Dr Constance Ikokwu, also condemn di attack and demand sharp investigation, arrest and prosecution of everybody wey get hand inside.

But APC come out, deny say e sponsor or take part for di attack.

Di Lagos APC tok tok pesin, Mogaji Seye Oladejo, dismiss di allegation, say e nor hold water.

E explain say dat same day wey dei attack happun, APC leaders and campaign officials dey busy with di party campaign flag-off for Epe.

Di party challenge NDC to provide credible evidence wey go link APC members to di incident.

 

Note: As of November 12, 2026, nobody don independently establish di identities of all di attackers or confirm any political party sponsor dem.

Dis mean say di allegation against APC still be accusation, no be confirmed finding.

Anybody Die or Sustain Injury?No confirmed report show say anybody kpai inside di November 12 attack for Oregun, Lagos.

However, reports show say some pipu sustain wunjury for di attack.

Politics Nigeria report say at least one pesin land for hospital, although di total number of pipu wey wunjure and their medical conditions never receive independent confirmation.

DiCable tori pesin, Samuel Adebanjo, also suffer physical attack.

Although one of di attackers reportedly use axe knack am for wrist, but him wristwatch prevent di weapon from touching im skin directly.

Di attackers also carry im recording equipment comot, including im camera, gimbal and microphone.

Wetin Gornment and Political Leaders Tok On Top Di Matter?House of Representatives

House of Representatives don condemn di increasing cases of political violence across Nigeria and resolve to investigate di incidents.

Dis follow one motion of urgent public importance wey Frederick Agbedi and 16 other lawmakers sponsor.

Di House unanimously adopt di resolution, calling for action against political violence.

Di lawmakers warn say attacks on political gatherings fit discourage Nigerians from taking part for democratic activities, and reduce public confidence for di electoral process and di 2027 general election.

Dem also remind political parties say Nigerians get constitutional right to peaceful assembly and political association under Section 40 of di 1999 Constitution.

 

Police Response

After di violence start for Lagos, police operatives arrive di scene and fire tear gas to scatter di crowd and restore order.

Di Assistant Commissioner of Police in charge of Operations for Lagos, ACP Ehindero Lawrence, later address NDC supporters and assure dem say police go protect dem.

However, as of di latest reports reviewed, Lagos State Police Command never release full public explanation about wetin happen or konfamate di identities of those responsible.

 

APC Presidential Campaign Council

Interestingly, APC Presidential Campaign Council also condemn di attack.

Di council toktok pesin, Dele Alake, call on security agencies to arrest and prosecute anybody wey dey responsible for attacks on political gatherings.

Di council also appeal to political parties, politicians and their supporters to control demself as election activities dey gather momentum.

 

Lagos APC

Di Lagos State chapter of APC also condemn di reported violence but insist say di party no get hand for di incident.

Di party maintain say anybody wey get credible evidence against di pipu wey get hand, say make dem submit am give security agencies for proper touchlight.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds