Dem Jaguda boys don carry dia own attack supporters of Nigeria Democratic Congress (NDC) as dem dey prepare for town hall meeting for NDC presidential candidate, Peter Obi, for Oregun, Lagos, on Thursday, November 12, 2026.
Di attackers storm di place around 11am with cutlasses, guns and other dangerous weapons, causing fight and panic.
NDC supporters fight back, catch one suspected attacker and hand am over to security pipo.
One eyewitness, Isaac Obasi, say five pipo wujure and 10 moto spoil for di attack.
One tori pesin follow wunjure, as di suspected attackers colobi im camera, microphone and other work tools.
Security pipo later arrive and fire tear gas to scatter di crowd and a
Reports say Peter Obi never reach di venue when di attack shele.