Pipo wey dey stay Orchid Road for Lekki, Lagos State, don para give Eko Electricity Distribution Company and the Transmission Company of Nigeria aka NEPA say dem go dey protest every month till dia light better.
Di residents for di Lekki Conservation Estate Community Development Area gather comot for weekend with placard to complain say dem dey pay big money for zero light.
President of di association, Bode Akinwande, press mouth say throughout October, di area nor even see light reach two hours join together, yet dem still send dem bill wey enter millions of naira.
Im tok say more than four months of darkness don scatter business and force about two hundred estates for orchid, schools and markets for di area spend plenty money buy diesel.
Meanwhile, on top dis same light matter di Commissioner for Information, South South, Edo State, Kazeem Afegbua, don come out yarn say e nor hear say Oga presido promise Nigerians 24 hours light
Afegbua konfamate dis tori for siddon tok yesterday Sunday 15th november say e nor hear anywhere weyOga Presido tok am . Im press mouth say nothing cheap for dis life, especially light matter.
Im still tok say Presido don try wella wella on top light matter.