As di 2027 general election dey use korokoro eye look us for one corner, politicians dey use any free chance wey dem see like dis to do campaign wey go secure dia position for inside gornment.
Dis na di matter wey we use our eye take see for inside di Lagos State House of Assembly on Monday, 16th of November 2026, as some lawmakers nor dey on seat for inside plenary.
As Right Honorable Speaker, Mudashiru Ajayi Obasa, see dis kind doings, e kon ask di members wey dey on ground say, Wetin dey sup? Why be say most of wi seat dey empty?
As nobody tok anything, Obasa kon tok say holiday don finish ooo and dat e understand say election dey for corner but that one nor mean say make lawmakers abandon dia duty.