Di African Democratic Congress (ADC) governorship candidate for Lagos State, Gbadebo Rhodes-Vivour, don point finger give APC say dem nor send di pipo of di state after 27 years in power.
Inside one message wey e drop for him verified X handle on Tuesday, November 17, 2026, Rhodes-Vivour tok say di ruling party nor know wetin ordinary Lagos pipo dey face, as dem dey organise campaign with light and pipo nor get light for house.
E still press mouth say upon di posters wey full everywhere, dirty full street and gutters, clean water nor dey, Â and road spoil as gornment dey share big big cars, so time don reach for democracy gornment.