Local

ASUU President Talk Say Lecturers Don Show Enough Patience Already

todayAugust 27, 2025 6

Background
share close

ASUU President, Christopher Piwuna, don talk say public university lecturers don endure reach their limit and dem deserve better treatment from government. E talk say, “We don dey drag this matter for long now. We don show patience, we don try understand, we don follow government talk well well to solve the wahala. Since democracy start for 1999, people dey quick blame ASUU say we too dey strike, schools dey always close but make dem ask wetin government don really do about am.” Na wetin Piwuna talk be this on Wednesday wen dem interview am for Channels Television program, The Morning Brief.

E come talk say even though ASUU don reach out to Tinubu government since dem enter power, the way government dey handle the mata slow like snail. “Since this government enter, we don meet two different Education Ministers first na Prof. Tahir Mamman, now na Dr. Tunji Alausa but wahala still dey. Government just dey do like say dem no get fuel to move. We dey ask, why e hard government to do wetin dem suppose do? We don try, we don hold body, schools still dey open because we wan give peace chance. But make I talk am clear we don show enough patience.” Meanwhile, ASUU members don protest across the country to remind Federal Government say dem never fulfill the agreement wey dem sign since, and if nothing change soon, strike fit happen again. The issues wey still dey ground na things like 2009 agreement, unpaid salary, promotion wey dem hold, and welfare of retired lecturers. Dem say government dey always do like say ASUU no matter, and if care no dey, dem no go get choice than to strike again.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app