News-auth

1027 Results / Page 105 of 115

Background

obodo oyinbo

Australia Cut Rope For Under-16s Say Make Dem Comot Social Media

By: Esther Ayoola Chai nor be small tin, say Australia  gorment don carry beta fight wey get odour  enter social media, say dem nor wan see any of dia 16 year old pikins for social media , facebook, instagram, youtube, and X on wednesday. According to the Australian gornment say dem wan take back the power from di tech sharks and dem dat, dem dey spoil dia childrensis for dem. […]

todayDecember 10, 2025 16

National

President Tinubu Repeat Im Order Say Make Police Officers Return To Normal Policing

By: Esther Ayoola Wi oga presido, Bola Tinubu don repeat talk again, say make police officers nor guard VIPs again and make dem return back to normal police work. E talk dis one just before e begin federal executive council meeting for state house, Abuja on Wednesday. From aproko wey reach konfam news table say, Tinubu don direct minister of interior make e work with IGP and NSCDC make dem […]

todayDecember 10, 2025 25 1

National

PDP National Chairmo Turaki Confamate 29 Chairmen Across States

By: Esther Ayoola The Pipos Democratic Parti  national chairmo, Tanimu Turaki (SAN)  don wia long nika, with long wire clear di air say, nothing like faction, nor divide for inside di parti,  say PDP still be  one house,  and dat 29 state chairmen tanda  gallant dey await  confirmation to work. Turaki dish di tori live for Abuja Wednesday during PDP state chairmen meeting, where 29 land physically for screening. he […]

todayDecember 10, 2025 13

Lagos

Lagos Police Kramp Two Traffic Robbers

By: Esther Ayoola Unto securioty doings, like dis, lagos police comand  don kramp two suspected traffic robbers for same place wia one woman blow alarm say gang dey wori pipo for ojota-ketu road, just one day ago. Di women, bin package message send directly to di Lagos Police Public Relations Officer, via X, SP Abimbola Adebisi, She yarn say four boys rush her car for ojota bridge for broad daylight, […]

todayDecember 10, 2025 16

obodo oyinbo

US FDA Launch Big Probe Into Reported Covid Vaccine Deaths

By: Esther Ayoola Di US Food and Drug Administration don open one mata dey touchlight deaths of US citizens, wey some people claim fit relate to Covid-19 vaccines. According to report, Since Presido Donald Trump appoint Health Secretary Robert F. Kennedy,  US gorment  big overhaul of vaccine policy, and dis move don raise worry among medical experts. Kennedy tuk tuk persin  Andrew Nixon tell tori pipo  say, FDA dey run […]

todayDecember 10, 2025 17 7

Lagos

Lagos Gorment Tell Civil Servants To Follow Computer Law

By: Esther Ayoola Unto computer movement, di lagos state don remix di 2025 public service rules, say dem no wan civil service wey dey drag leg again for this modern world. Head of service, Bode Agoro, nai tanda gigigba  yesterday dey tell state  workers say di old 2015 law book don old to run mata for modern time, and dat e no fit handle today digital speed and global standards […]

todayDecember 10, 2025 10

National

Vice Presido Shettima Clear Tinubu Security Doings

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido Kashim Shettima don align marras say, president Bola Tinubu nor dey security matter play at all at all. Oga vice dey yan dis one for inside  NISS 18th executive intelligence management course crew for him office for abuja. Say, na about 78 guys including  commandant joseph odama, ni come  drop their final course report for VP. Shettima carry the report, yan say government dey […]

todayDecember 10, 2025 19 1

Lagos

Three Die As Three Motor Jam Demselves For Lagos-Ibadan Expressway

By: Esther Ayoola Wahala nor dey finish, say another one don burst for Lagos Ibadan express way  wia three motor jam demselves, three people  kpai on the spot  and plenty others dey hospital dey take treatment. Lagos state traffic management authority (LASTMA) confamate give tori pipo say the accident spoil things for the area. The koko happen near secretariat, as people dey waka go Otedola bridge, traffic jam choke everywhere. […]

todayDecember 10, 2025 8

National

Senate Raise Alarm Say WAEC Wan Stress SS3 Students

By: Esther Ayoola Nor be small gbege for  di Nigerian Senate, say Naija education  dey dey shakibalabala based on WAEC sudden change of  curriculum and  dat, SS3 students wey  go register for the exam go  write subjects wey dem never even see. Na so Lawmakers fire the mata on Tuesday yarn say dem go call Education Minister plus all top heads make dem explain why dem di ss 3 chidrensis  […]

todayDecember 10, 2025 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app