News-auth

1027 Results / Page 99 of 115

Background

south west

Southwest States Join Hand Launch “Joint Show Of Force” To Tackle Highway Banditry

By: Esther Ayoola Oyo, Ogun and Lagos states don join hand launch joint security operation to stop banditry and wahala for highways and towns for southwest. Di operation, wey dem call “joint show of force,” dey target high-risk roads like Lagos–Ibadan expressway make commuters, residents and businesses safe, as police begin di exercise from Lagos side go Ojoo, Ibadan on Monday. CP Fatai Owoseni (RTD), special adviser to Governor Seyi […]

todayDecember 23, 2025 10

National

FG Make Pre-Employment Drug Test Mandatory For All Public Service Workers

By: Esther Ayoola Di federal government don approve say all prospective workers for Nigerian public service must do drug test before dem fit get job, di office of di secretary to di government of di federation (OSGF) announced in a service-wide circular dis week. According to director of information and public relations for OSGF,  Segun Imohiosen, di move na to curb rising drug abuse and protect national productivity and security. […]

todayDecember 23, 2025 7

south east

Imo Governor Present N1.4 Trillion “Budget Of Economic Breakthrough” For 2026

By: Esther Ayoola Governor Hope Uzodimma of Imo state don present #1.4 trillion budget proposal for 2026 to Imo house of assembly on Monday. Di budget wey dem call “budget of economic breakthrough” show say #238 billion go dey for recurrent expenditure while #1.2 trillion go dey for capital projects. Uzodimma talk say 83.4% of di budget na capital expenditure, and 16.6% na recurrent expenditure.

todayDecember 23, 2025 9

obodo oyinbo

Israeli Soldiers Go Kill Two Men For Gaza Spoil Ceasefire

By: Esther Ayoola Israeli forces don kill at least two Palestinians for Gaza strip as ceasefire no dey respected and humanitarian aid still dey blocked. According to report, di two people die afta Israeli soldiers fire for Shujayea area, eastern part of Gaza city. Dis bring total number of Palestinians wey don die for di past 24 hours reach 12, including eight wey dem comot from rubble. Gaza government tuk […]

todayDecember 23, 2025 6

Sports

Tanzania Eyes First Ever Afcon Win Say Na Nigeria Dem Wan Take Start

By: Esther Ayoola Tanzania cochie, Miguel Gamondi,  ni bring mata dis morning on say if  dem fit finally get dia first victory when dem play Nigeria for 2025 AFCON for Morocco on Tuesday, e go belike say na world cup dem win. Di taifa stars don play three AFCON tournaments—1980, 2019, and 2023—and dem never win any of dia nine matches, so dis group C opener go be dia 10th […]

todayDecember 23, 2025 6

Sports

Super Eagles Train For Morocco Ahead AFCON Match With Tanzania

By: Esther Ayoola Super Eagles don hold dia fourth training session for FES, Morocco, on Sunday as dem dey prepare for dia 2025 AFCON Group C match against Tanzania on Tuesday. Nigeria go face Tanzania for di Complex Sportif de Fes for dia first Group C game. Di team wey land Morocco last Thursday don also train on Friday and Saturday to sharpen dia preparations. Before dem reach Morocco, di […]

todayDecember 22, 2025 13

obodo oyinbo

US Dey Chase Venezuela Oil Tanker Over Sanctions

By: Esther Ayoola Di United States don start to chase anoda Venezuela oil tanker for international waters as part of dia pressure against President Nicolas Maduro government. Dis one come just one day afta US Coast Guard seize di second vessel near Venezuela coast within two weeks under one “blockade” wey former President Donald Trump order. One US official tell reporters say di tanker na part of Venezuela “dark fleet” […]

todayDecember 22, 2025 12

National

Akpabio Carry Natasha Suspension Mata Go Supreme Court

By: Esther Ayoola Senate Presido, Godswill Akpabio don carry matter of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan suspension go Supreme Court. Dis one dey sup, afta Court of Appeal for Abuja send Federal Government message dat Akpabio no follow court rules well. Court documents show say Akpabio file di appeal since December 1, 2025.

todayDecember 22, 2025 16

National

FG Declare Dec 25, 26 And Jan 1 Public Holiday For Christmas And New Year

By: Esther Ayoola Federal government don declare Wednesday December 25 and Thursday December 26, 2025, as public holidays to celebrate Christmas and boxing day. Government also tuk say Wednesday January 1, 2026 go be public holiday for new year celebration. Di announcement come from ministry of interior permanent secretary, Dr Magdalene Ajani, on behalf of interior minister Olubunmi Tunji-Ojo. Di minister urge Nigerians make dem reflect on love, peace and […]

todayDecember 22, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app