News-auth

1027 Results / Page 101 of 115

Background

National

Fuel Tanker Blow Auchi Road

By: Esther Ayoola Gobe burst for Auchi, Edo State, as one tanker wey explode kpai kpai pipo for di areas. According to police tuk tuk of Edo state, Eno Ikoedem, wey confamate di tori, na Wednesday around 6:30pm for evening na dis gbege sup. People dey ask, who dey involved, how e take happen, and how many pipo dem fit don jam. Once more detail come, u go get am […]

todayDecember 19, 2025 15

Sports

Junior D’tigress Naija Jump Nine Places For FIBA World Ranking

By: Rilwan Agbomeji Right now, na junior dey hot for basket ball , say dem climb nine places for di latest FIBA world ranking for girls, moving to 26 for world. Di ranking wey come out for Thursday, show say Naija na di fourth biggest movers as dem jump from 30 to 26. For Africa, Junior d’tigress dey for number three with 469.5 points, behind Mali wey dey 16th and […]

todayDecember 19, 2025 38

National

Oil Regulators Say Dem Wan Hawk Naija Crude Oil For Showglass

By: Esther Ayoola Hear mata, say di presidential nominees for Nigeria petroleum regulatory agencies don go promise wi senate, say dem go make sure local production become number one, di champion for Naija petrol mata, and say import go be only last option to cover supply gap. Based pressure wey dem face for dia screening for senate on Thursday, omo, dem nor know wen dem promise heaven and earth oh, […]

todayDecember 19, 2025 13

Sports

Joshua Ready To Whack Jake Paul For Miami Ring Fight

By: Esther Ayoola Naija, UK senior boxer Anthony Joshua say im don package beta blow for youtuber, Jake Paul for ring today for Miami, say Paul chor chor tukings, na today im go tidy am for ring. Joshua tuk say e wan beat Paul make other online tuk tuk dem learn, dat, nor by to tuk and dat boxing dey im blood, even afta im loss to Daniel Dubois last […]

todayDecember 19, 2025 19

obodo oyinbo

Trump Arrange Mhen Make Dem Rename Kennedy Art Center

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump omo with all bodness buy waka go rename top arts centre for Washington afta himself based on working. According to Konfam aproko wey come out, Kennedy center wey dem first name afta president John f. Kennedy, say now, dem go dey call am “Trump-Kennedy centre” afta board wey trump choose vote ama. Dis move na example of how trump dey influence big institutions […]

todayDecember 19, 2025 8

National

Oga Presido Tinubu Cut Chain For 9ja Governors

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don cut chain oh, wia dis vex come from sef nor bodi sabi, say mama Remi never rob im head some time, omo jagaban, enter meeting for Abuja for di mata, change am 9ja govos and APC members say make dem support di idea of state police and local government autonomy. Oga presido yanyanpu dis one for di 14th APC National Caucus […]

todayDecember 19, 2025 8

Lagos

Lagos Court Put Man For Kirikiri For Property Yahoo Yahoo

By: Esther Ayoola Starting with matas for Lagos, say one Lagos state high court for Ikeja don tie one  mata  for one  Chidi Nwaya head like gala, sentence am to 22 years for kirikiri, say im na ole and im yahoo  N28 million  for one failed property deal for Lagos island. Justice Modupe Nicol-clay, sama  am  beta two separate jail terms, 15 years, and 7 years, but say, im go […]

todayDecember 19, 2025 10

Niger Delta

Delta Assembly Pass 2026 State Budget Sharp Sharp for Two Weeks

By: Esther Ayoola Delta State House of Assembly, on Monday, don pass di 2026 State Budget of 1.7 trillion naira. Di approval happen for Asaba, two weeks after Govnor Sheriff Oborevwori present di budget to di House. Di new figure big pass di earlier proposal by 65.6 billion naira, as lawmakers adjust am to meet state needs. Breakdown show say 500 billion naira go for recurrent spending, while 1 trillion, […]

todayDecember 16, 2025 13

National

Malami Don Point Hand Give EFCC Say Dem Dey Play Wayo

By: Esther Ayoola Former AGF and Justice Minister, Abubakar Malami, don raise dust on Monday as e demand make EFCC oga rescue himself from any investigation wey concern am. Through im spokesman, Muhammad Doka, Malami allege say EFCC dey run di probe with bias, personal beef and political witch-hunt because e just comot go ADC party. Di former minister accuse anti-graft body of illegal detention, media wahala and breaking due […]

todayDecember 16, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app