News-edi 1

1452 Results / Page 1 of 162

Background

obodo oyinbo

Plenti Flight Cancel Afta US-Iran Fire Each other

Flights don scatter everywhere, as thousands of passengers dey stranded as US and Israel attack on Iran make global air travel choke. Countries like Iran, Israel, Qatar, Iraq and UAE lock dia space for air as missile and strike action burst for Gulf region. Airlines from Europe, Asia and America cancel plenti flights as tension for Middle East still dey hot like fire. Iran sharpaly lock dia airspace until further […]

todayMarch 1, 2026 3

obodo oyinbo

Iran Strike Israel and US Base Afta Khamenei Kpai

Iran launch fresh wave of missile and drone attack on Sunday, target 27 US military base for di region and Israel military headquarters for Tel Aviv, say na payback afta big US-Israel strike kill Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei. Iran army for statement wey dem show for state TV talk say dia air force bomb US base for Gulf countries and Kurdistan region of Iraq for different phases of operation. […]

todayMarch 1, 2026 3

OBODO NAIJA

NAFDAC Staff For Lagos Lock Out As Union Protest Sachet Alcohol Ban

Operations for National Agency for Food and Drug Administration and Control office for Lagos State don scatter on Wednesday as union members lock NAFDAC compound gate for Isolo. Staff wey come early go work no fit enter as members of National Union of Food, Beverage and Tobacco Employees block both entrance and exit gate to protest. Dem dey protest because NAFDAC still dey enforce ban on alcohol wey dem dey […]

todayFebruary 26, 2026 3

OBODO NAIJA

Court Postpone Anthony Joshua Driver Trial

Magistrate court don adjourn di trial of di driver wey involve for crash wey affect boxer Anthony Joshua, as prosecutors go seek legal advice from Ogun State DPP. Di driver, Kayode, appear for court on Wednesday over reckless driving allegation, as prosecutor Kadiri tell court say dem don send di case file go Ogun DPP for review. Police counsel earlier ask for adjournment make dem fit duplicate case file and […]

todayFebruary 26, 2026 5

OBODO NAIJA

Edo Govment Condemn Attack On ADC Members

Edo state Govo Monday Okpebholo of Edo State don condemned di recent attack wey happen to members of di African Democratic Congress (ADC), for tori wey busrt come out on Tuesday night, wey im describe as internal party gbege wey don enter another level. Di govo wey sympathise with di affected members of di party talk say jaguda boys from ADC don carry dia gbege enter peaceful Edo state, say […]

todayFebruary 26, 2026 3

OBODO NAIJA

ADC Coatiate How Attack Happen

Before Before Labour party candidate for Edo state Barr. Olumide Akpata don coatiate how di attack happen untop ADC members for Edo state. Olumide yarn dis matter on Wednesday for sitdown tv tuk say them get intel say gbege go happen for where them gather for their party congress for Edo state on Monday where plenty supporters gather. Im further yarn say dis gbege happen just few minutes from di […]

todayFebruary 26, 2026 4

Lagos

Olatunji Disu Enter Office As Acting IGP  

Olatunji Disu don enter office as new acting IGP for Nigeria Police Force, as e begin carry big security responsibility for country. Disu take over on Wednesday, become di new police oga wey go dey control security operations for obodo Nigeria. E talk say e go push for serious policing to help fight jaguda doings for inside Nigerian. People dey watch sharp sharp to see how im leadership go change […]

todayFebruary 26, 2026 5

obodo oyinbo

Kim Jong Un Talk Say E Go Boost Nuclear Power For North Korea

North Korea Leader, Kim Jong Un don yarn say e go boost North Korea nuclear weapons power, as e waka go watch big night military parade with im daughter. Around 14,000 soldiers march for Pyongyang Kim Il Sung Square, dey goose-step under strong floodlight as fighter jets dey shout for sky. Kim daughter, wey people dey suspect say fit be Ju Ae, show face beside her papa for parade, but […]

todayFebruary 26, 2026 4

Sports

Osimhen Nor Too Happy With Galatasaray Win Over Juventus

Super Eagles striker Victor Osimhen talk say e no sweet am di way Galatasaray play, even though dem still knock Juventus comot for UEFA Champions League play-off on Wednesday. Galatasaray manage crawl enter Round of 16 with 7-5 aggregate win afta extra-time battle for Turin, despite say Juventus nearly turn di tie upside down. Osimhen drag one goal back when Juve bin don lead 3-0, push di aggregate to 6-5, […]

todayFebruary 26, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app