News-edi 1

1354 Results / Page 1 of 151

Background

National

Police Clear Nigerians, No Fight Criminals If Dem Attack You

By: Rilwan Agbomeji Naija Police Force don open ogbonge secret, say, make Nigerians no try struggle or fight Jaguda boys, particularly di once wey carry dangerous weapon, to beg for survival instead. Police  tuk, tuk, Benjamin Hundeyin,  na dey yarn dis one on Tuesday for live tv sitdon tuk. Say like dis, di Naija police dey up of dia game, an dem dey handle di security challenges for di obodo […]

todayJanuary 14, 2026 5

foreign

Russia Warn Foreign Hands Wey Dey Put Mouth For Iran Marras

By: Rilwan Agbomeji Di story dey worwor every day for Iran, say Iran UN ambassador don go put accusation for  US Presido, Donald Trump head, dat Trump dey look for Iran trouble dey encourage violence. U sabi say, Trump for media yarn say di endgame na to win Iran and make dia pipo protest and take control of di govment. Internet don off for Iran for pass five days as […]

todayJanuary 14, 2026 8

Sports

Naija Set For Davis Cup Clash Against Uzbekistan For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Say now, all don set for Davis Cup, di ogbonge table tennis World Group II match, wey go shelle between Naija and Uzbekistan for Lagos from February 7–8, 2026. Organisers say dem don ready for everything, from technical to security and logistics. Oga Presido of Naija Tennis Federation, Victor Ochei, wey tori pipo touchlight im frequency on Tuesday, say dis show say, Naija dey shine for international […]

todayJanuary 14, 2026 3 4

Sports

Mbappe No Dey Training As Arbeloa Take Charge For Real Madrid

By: Rilwan Agbomeji Striker Kylian Mbappe no show for Real Madrid training on Tuesday in Spain as new coach Alvaro Arbeloa take charge for im first session. Arbeloa, wey replace Xabi Alonso on Monday, go lead im first game against Albacete for Copa del Rey on Wednesday, but Mbappe fit no feature. Mbappe just return from knee sprain as late substitute for Spanish Super Cup final wey Real Madrid lose […]

todayJanuary 13, 2026 6 6

foreign

Over 100 Pikin Don Die For Gaza Since Ceasefire

By: Rilwan Agbomeji Di UN children’s agency, UNICEF, on Tuesday report say over 100 pikin don die for Gaza since October ceasefire. UNICEF spokesperson, James Elder, tell reporters for UN briefing by video link from Gaza say di dead include 60 boys and 40 girls, mainly from military attacks. E explain say di attacks happen through air strikes, drone strikes, tank shelling, gunfire, and quadcopters, while small number na from […]

todayJanuary 13, 2026 5 3

foreign

French Far Right Politician, Marine Le Pen Face Court Appeal

By: Rilwan Agbomeji Marine Le Pen, wey be far-right French politician, say go nor appeal court decision wey ban her from public office for five years. U sabi say, dem find her guilty last year say she embezzle EU money, but she talk say she never do any wrong. If court hold di ban, she no go fit run for 2027 presidential election. Jordan Bardella, wey be her party president, […]

todayJanuary 13, 2026 3 3

National

How Jaguda Boys Do Warling Film For Obajana Police HQ

By: Rilwan Agbomeji Say nor be small war start film play for Obajana Police Divisional Headquarters for Kogi State, dat jaguda boys enter di area and begin shoot wetin nor good kill one civil defence guide, but last last face and scata dem. Several security personnel and vigilante members sustained gunshot wunjor for di mata oh. Resident say di mata wey sup from Sunday to Monday night nor allow dem […]

todayJanuary 13, 2026 5 2

foreign

Iran Minister Drop Yarns Dat Iran Nor Go Legbere For Anybody

By: Rilwan Agbomeji Iran Foreign Minister Abbas Araghchi, once again don tuk oh, say Iran ready for war if America wan “test” dem. Dis dey come afta US President Trump warn say im fit use military over Iran protests. Protests start over money wahala but don grow to big calls for system change. Ontop interview with tori pipo,  E say tuk channels with US still open but Iran military strong […]

todayJanuary 13, 2026 4 3

Sports

Dan Evans, Oda Brit Tennis Players Chop Defeat For Australian Open

By: Rilwan Agbomeji Great Britain tennis player, Dan Evans go fall hand for Australia, fail to reach Australian Open main draw. Im go lose inside first round for qualifying phase wey sup for Melbourne. Na so im service weak like dodo, lose 6-1, 6-2 to Japan player Rei Sakamoto. Oda Britons, Jay Clarke and Jack Pinnington Jones, also lose straight sets, and Oliver Crawford lose 6-3, 2-6, 6-3 to Spain […]

todayJanuary 13, 2026 7 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app