News-edi 1

2592 Results / Page 2 of 288

Background

Lagos

Trailer Buy Waka Go Jam Two Buses for Berger, Wunjure Five

No be small eruku burst for Berger bus stop  Lagos, say one trailer  go do  eye-service jam  two commercial bus, wojure  five pipo yangayanga for ground. Lagos traffic pipo naim rush go  rescue di victims carry dem go hospital, while police come pack di broken motor go station make investigation start. LASTMA  oga Olalekan Bakare, sef konfamte dis mata, wia e tell di victims family sorry. Bakare konfam say, di […]

todayOctober 14, 2026 4

Lagos

Police Gbab 4 Suspected Cultist For Lekki, Ajah Area

Lagos State Police Command  don do small Rambo go kramp  four suspected cultists jaguda boys, say dem bin dey do jaguda doings for  Lekki, Ajah and Elemoro area. According by statement wey police tok tok pesin, Adebisi Abimbola release say dem arrest one Arisekola Ojo, Oluwatobi Oyewole, Oluwaseyi Odunewu and Olumagba Ifatope. Abimbola konfamate say police nor be winch say na information wey di suspects by diasef give during di […]

todayOctober 13, 2026 7

OBODO NAIJA

How Women Leaders Raise Hand Support Tinubu/Shettima Ticket

Di election breeze take dey blow nor be small, group just dey do alignment support group up and down, na so yesterday one women political group wey call demselves Nigerian Women for Tinubu/Shettima 2027 (NWFTAS 2027), go promise re-election for Tinubu/Shettima ticket inside Aso rock. For una wey never get voter card, oyo na your case oh, women dey play front for Abuja like dis like dis. Senior man vice […]

todayOctober 13, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Cut Chain Follow Pikin Former Girl Friend

Senior man Presido of America, Donald Trump don open case and plan to sack hin pikin former girlfriend, wey be US ambassador to Greece, Kimberly Guilfoyle, based on say she bin use back door clear her loans. As tori pipu ask Trump wetin hin go do to hin first pikin Donald Trump Jr former fiancee,  senior man squeeze face, tok  say make dem leave di mata to am, say hand […]

todayOctober 13, 2026 8

Sports

Ronaldo Near 1,000 Goals as Im Score 981st Career Goal

Cristiano Ronaldo don score im 981 goal for career as Al-Nassr beat Neftchi Fergana team from Uzbekistan 3-1 for di AFC Champions League Elite match on Monday. Di 41-year-old Portuguese superstar score di second goal for Al-Nassr for di 42nd minute after Angelo Gabriel bin open score for 33rd minute inside Al-Awwal Park stadium for Riyadh. Sadio Mane float one sharp cross from di left, Aiman Yahya use im chest […]

todayOctober 13, 2026 6

Lagos

LAWMA Close Over 25 Buildings Say Dem Dey Dirty Lagos

Lagos waste management pipo, don carry dia hammar knack, beta  akpako untop over 25 buildings, including one filling station, lock everywia for  Ago Palace Way, Okota, Lagos, say na dem dey make lagos dey smell. LAWMA oga Director, Dr Muyiwa Gbadegesin, naim by himself lead di operation with hin street sweepers naim dem take package di clearing Dem also kramp some boys wey dey use dia small barrow dey park […]

todayOctober 13, 2026 6

OBODO NAIJA

Minister Umahi Fry Mouth As Plans Dey Go For Lagos Calabar Coastal Highway

You sabi dat report wey bin fly up and down yesterday say di federal gorment wan change plans for di Lagos Calabar costal highway, story don change oh, in fact wi Minister of Works, David Umahi, say make Nigerians nor mind bad belle pipu wey dey spread fake news. Say di plans for di 750-kilometre Lagos-Calabar Coastal Highway project sti dey intact. Oga Umahi clear di air give Baba Seyi […]

todayOctober 13, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Drag Putin, Zelenskyy to stop Dia Nonsense War

US Presido, Donald Trump don blow grammar for ground again oh, say make both Russia and Ukraine  stop to attack, say na war wey nor make sense dem dey fight. Trump tok dis one on Monday even as Ukrainian President Volodymyr Zelenskyy dey complain say Russian soldiers don sti go bomb at least six energy centers for Ukraine after peace agreement on Sunday When reporters ask Trump about di new […]

todayOctober 13, 2026 7

Sports

Jay-Jay Okocha Back Mbappe For 2026 Ballon d’Or

Super Eagles legend Jay-Jay Okocha don back Real Madrid star Kylian Mbappe to win di 2026 Ballon d’Or award. Di former PSG playmaker tok dis one during interview with French paper Le Journal du Dimanche, wia fry mouth  say Mbappe goal-scoring record make am stand out pass order top players like Harry Kane and Lamine Yamal. Okocha explain say Mbappe deserve di big prize because e finish as top scorer […]

todayOctober 13, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds