News-edi 1

2592 Results / Page 3 of 288

Background

Sports

Kayode Oke Score Goal After 18 Seconds

Kayode Oke, wey dey play for Bendel Insurance, score di quickest goal for dis season NPFL as e put ball for net just 18 seconds after match start against Sporting Lagos for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos. Even though Oke give im team early lead, Bendel Insurance no fit maintain di lead as Sporting Lagos fight back to win di match 2-1. Victor Samuel score di equaliser for Sporting Lagos […]

todayOctober 12, 2026 8

obodo oyinbo

One Kpai, 11 Wound For Saudi Airport Attack

One person don kpai, while 11 others don wound for attack on King Khalid International Airport for Saudi Arabia. Di attack happen hours after Houthi media report say airstrike hit airport for Sanaa, di capital of Yemen wey rebel dey control. Iran Foreign Ministry spokesperson, Esmaeil Baghaei, talk say Iran dey seriously worry about wetin dey happen for Arabian Peninsula. E say di way di wahala dey increase go only […]

todayOctober 12, 2026 11

OBODO NAIJA

LCCI Beg Gornment Make Petrol Price Drop by 15 to 20 Per Cent

Lagos Chamber of Commerce and Industry, LCCI, don ask federal gornment make dem reduce petrol price by 15 to 20 per cent within six months, so e go reduce di heavy cost of fuel and transport wey dey affect businesses and ordinary Nigerians. LCCI Director-General, Dr Chinyere Almona, welcome gornment plan to control petrol price, including di proposed ₦1,350 per litre limit for petrol cost before e reach filling stations, […]

todayOctober 12, 2026 12

OBODO NAIJA

Chief of Staff, Segun Ogunwuyi, Resign From Hin Job 

Segun Ogunwuyi, wey be Chief of Staff to Oyo State Govo, Seyi Makinde, don resign from di gornment on Monday, October 12, 2026. For im resignation letter, Ogunwuyi say im resignation start to dey effective from di same day wey im write di letter. Ogunwuyi, wey don serve before as member of Oyo State House of Assembly and House of Representatives, na one of several aides wey don resign from […]

todayOctober 12, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Promise No Attack For Iran Again Until November 3rd

By: Mariam Ajayi Iran military force don konfamate say dem dey do operation every night inside Strait of Hormuz to catch any ship wey break dia law. Mean wider, President Donald Trump say US for dia on part sef dey tuk with Iran and promise say, dem nor go attack dem before di November 3 midterm election. Already Dis tension don make oil price jump up by four percent, carry […]

todayOctober 9, 2026 10

OBODO NAIJA

Atiku Condem FG 30 days Giveaway Petrol Plan

By: Mariam Ajayi Pepper bodi every wia as wi Federal gorment take announce say dem wan package 30 days give away price for petrol inside NNPC filling stations across di obodo Naija. Latest to fire mouth untop di mata, na di Africa Democratic Congress, ADC, presidential candidate, Atiku Abubakar. Di b4 vice presido say di APC gorment na desperado naim dey do dem and dis wan nor go do anything […]

todayOctober 9, 2026 9

Lagos

Lagos Gorment Beg Youth To Put Bodi For Military Recruitment

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don begin toast lagos youths wey dey between 18 and 26 years say make dem join  military sake of say di state need meet  dia recruitment quota. Say dis nor be to look and thruway face like say insecurity nor concern youth, dat naija reallyneed beta collabo and energy to battle insecurity. Senior man Seco to di Gornment, Abimbola Salu-Hundeyin, naim drop dis micro […]

todayOctober 9, 2026 7

Lagos

Hit And Run Driver Jam Teenager For Onipanu BRT Lane

By: Mariam Ajayi One teenage boy don land for hospital after hit and run driver jam am as e dey cross Onipanu BRT corridor dey go Fadeyi for Lagos State on Wednesday. Di boy sustain serious head and leg injuries for di accident, according to wetin di Permanent Secretary of LASEMA, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, talk. LASEMA Cobra Team sharp-sharp run reach di scene within two minutes around 4:32 pm to […]

todayOctober 8, 2026 12

OBODO NAIJA

AAU Lecturer Kpai Inside Hotel Room For Edo State

By: Mariam Ajayi One senior lecturer for Ambrose Alli University, Ekpoma, Dr. Matthew Uwuigbe, don kpai inside one hotel room for Edo State after e reportedly lodge with one 21-year-old woman. Police say di woman comot go buy water for am, but when she come back, she see di lecturer kpai for di room and raise alarm, as police don arrest her, di hotel owner and manager for investigation. AAU […]

todayOctober 8, 2026 13 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds