News-edi 1

2355 Results / Page 109 of 262

Background

OBODO NAIJA

Türkiye Promise To Tanda With President Tinubu To Rascal Terrorism

By: Rilwan Agbomeji Turkish Presido Recep Erdogan don go promise wi oga presido, Bola Ahmed Tinubu, say Türkiye dey ready to support Nigeria fight against all di jaguda boys bad, bad doings for Naija. Say im ready to joinbodi with Naija military to do training with wi army dem. Erdogan yarn dis one for joint press conference with President Bola Tinubu during Tinubu official visit to Ankara. Na baba seyi […]

todayJanuary 28, 2026 22

Lagos

Lagos Gorment Clear Mata Of Tax Collection

By: Rilwan Agbomeji Oga Chairmo of Lagos State Internal Revenue Service (LIRS), Dr. Ayodele Subair, don clear mata say, dem nor dey debit any company account directly if dem never pay tax. E yarn dis one for tv sit don tuk, say LIRS just wan collect unpaid tax from companies to fit provide beta things for Lagos. Subair explain say, nobodi go impose tax on person or companies wey dem […]

todayJanuary 28, 2026 13

Lagos

Police Arrest Jaguda Wey Threaten To Bomb Lagos School

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Police command don arrest one man, Kosiso Chukwem-Nenyem, say n aim send di alleged bomb threat messages via WhatsApp to two schools for Lagos. Commissioner of Police, Olorundare Moshood Jimoh, talk dis one when e dey brief tori pipo for Command Headquarters, Ikeja, on recent security operations. Jimoh press tuks on di arrest wey dem  don make for past  di weeks.

todayJanuary 28, 2026 18

obodo oyinbo

Trump Set Up Board Of Peace For Davos Summit

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump don launch im new Board of Peace for Davos with $1 billion membership fee Leaders from 19 countries, including Trump padi dem from Argentina and Hungary, sign di founding charter. Board suppose dey manage Gaza peace, but e fit settle oda international wahala too, wey dey make people fear say e wan compete with UN.

todayJanuary 22, 2026 19

Sports

Osimhen Dey Call Lookman, Onyedika Make Dem Join Am For Galatasaray

By: Rilwan Agbomeji Galatasaray and Super eagles Striker, Victor Osimhen don yarn say e dey try make im Super Eagles padi, Ademola Lookman and Raphael Onyedika, join am for Galatasaray. Di Naija striker talk dis afta Galatasaray draw 1-1 with Atletico Madrid for UEFA Champions League match wey happen on Tuesday night for Rams Park. Osimhen yarn say e dey work actively to bring Onyedika and Lookman enter im team, […]

todayJanuary 22, 2026 32 2

Entertainment

DNA Clear Davido For Pikin Wahala – Im Papa Talk

By: Rilwan Agbomeji Dr. Deji Adeleke, wey be papa of Afrobeats star Davido, don yarn say DNA test don show say im pikin no be papa of one girl wey dem dey call Aanu. Di mata don dey gbege before, but Dr. Adeleke yarn am for journalists for im Lagos house on Wednesday. Im talk say di DNA test wey hospitals for Lagos do show say di girl no be […]

todayJanuary 22, 2026 28 1

Lagos

Lagos Govment Tell Obalende Bridge Squatters To Comot

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govment don give squatters wey dey under Obalende bridge small small time make dem comot as dem wan beautify di place. Untop yarnings with tori pipo yesterday, Commissioner for Environment, Tokunbo Wahab, talk say dem don dey tell dem since 2024, and enforcement officers dey ground to carry out di quick notice. According to report Gornment wan hand over di space to company wey wan […]

todayJanuary 22, 2026 12 1

OBODO NAIJA

NAFDAC Start Work On Top Sachet Alcohol Ban

By: Rilwan Agbomeji Di National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC, don begin to enforce di ban on production and sale of alcohol for sachet and small PET bottle wey no reach 200ml. Director-General of NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye, talk am for media briefing for Lagos, say Senate don give dem final order to go ahead. She say although Federal Govment bin say make dem pause di […]

todayJanuary 22, 2026 16

OBODO NAIJA

APC Declare Say Tinubu Dey Set For Second Term

By: Rilwan Agbomeji Di National Chairmo of di All Progressives Congress, Prof. Nentawe Yilwatda, on Wednesday don enter area for Abuja dey canvas for Northern support Presido Bola Tinubu second term. Untop yanings for Northern leaders meeting for Abuja yesterday, Yilwatda declare say President Tinubu dey well for second term because of youth support, good policies, party growth, and organized mobilization wey dey di APC. Party leaders for Abuja still […]

todayJanuary 22, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds