News-edi 1

1466 Results / Page 15 of 163

Background

Lagos

Lagos State Varsity Don Open Job Recruitment For Students

By: Rilwan Agbomeji Lagos State University (LASU) don start recruit students enter LASU Cadet Corps, as dem officially announce am for X dis week. Di programme na student-focused paramilitary and leadership training, wey go help build discipline, patriotism, teamwork and leadership skills among undergraduates. How e go work be say cadets go also help with campus security, orderliness and official school events inside LASU. So if you be student wey […]

todayJanuary 9, 2026 11

Sports

CAF Comot Referee For Super Eagles Match Against Algeria

By: Rilwan Agbomeji CAF don comot Somali referee Omar Abdulkadir Artan from handling Super Eagles vs Algeria quarter-final for AFCON 2025, wey go happen Saturday for Grand Stade de Marrakech. Na because dem catch am say e wear boot brand wey no dey approved by official sponsors for one earlier match, and that one break CAF rule. Even though na di same man wey win Referee of di Year for […]

todayJanuary 9, 2026 16

Sports

Mahrez Yarn Say E No Fear Super Eagles Attack At All

By: Rilwan Agbomeji Algeria captain Riyad Mahrez don talk say e no dey fear  Super Eagles attack at all at all, ahead of Nigeria vs Algeria quarter-final for AFCON 2025 dis Saturday. Di Desert Foxes and Super Eagles go meet again for anoda big rivalry match as dem both enter knockout stage unbeaten. Nigeria don score 12 goals so far, pass any oda team for di tournament, but Mahrez still […]

todayJanuary 9, 2026 18 2

National

INEC Open Phase Two For Voter Registration For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don drop message for all Lagosian phone, wey never register with INEC, to go do dia voter registration. Resident Electoral Commissioner (REC) for Lagos, Ayobami Salami, ni on di message on Thursday. Say, Di first phase of voter registration end December 10, 2025, but di second phase don start since January 5, 2026, and dey happen for all local government areas […]

todayJanuary 8, 2026 14 2

National

ADC Swear For New Chairmo To Do Constitution Review

By: Rilwan Agbomeji National Chairmo of Africa  Democratic congress, David Mark, don  go swear  Senior Lawyer,  Etigwe Uwa (SAN)  say make im do  Chairmo for di party Constitution Review Committee for Abuja. Untop marras wey sup for di party headquarters for Abuja on Thursday, Mark tell di committee make dem work framework wey go promote inclusiveness, transparency and accountability, and still follow di party original principles. Im say di party […]

todayJanuary 8, 2026 7

Sports

CAF To Run WAFCON Draw 2026 Fixtures For Morocco

By: Rilwan Agbomeji Confederation of African Football (CAF) share update say di Women African Cup Of Nations  2026 final draw go hold for Rabat, Morocco on Thursday, January 15. According to CAF official post on X, Di draw go start 2pm local time (1pm GMT) For di same day, CAF go announce winners for Women Coach of di Year, Interclub Player of di Year, and Women Club of di Year […]

todayJanuary 8, 2026 10

National

Afenifere Don Raise Alarm As Terror Attacks Dey Plenty For Yorubaland

By: Rilwan Agbomeji Afenifere, di pan-Yoruba socio-political group, don yarn say dem dey worried about di way terror attacks don increase for Yorubaland and oda parts of Nigeria. For statement wey dem release for Ibadan, di group publicity secretary, Jare Ajayi, call South-West governors make dem act on di security resolutions wey dem agree on for dia meeting on November 24, 2025. Recently, gunmen attack forest guards for Old Oyo […]

todayJanuary 8, 2026 8

foreign

Oxford English Dictionary Add Naija Words Like “Amala” and “Abeg”

By: Rilwan Agbomeji Di Oxford English Dictionary don add some Nigerian words come dia book, like “mammy market,” and “amala.” Di update, wey dem release for Wednesday, include over 500 new words, phrases, and tenses. Di dictionary say dis show how Nigerian language, culture, and food dey influence di world. Other Naija words wey dem add na “moi moi,” “abeg,” “biko,” and “Ghana Must Go,” plus internet slang like “DM,” […]

todayJanuary 8, 2026 10

Sports

FG Promise To Clear Super Eagles Bonus, Say Money Go Enter Friday

By: Rilwan Agbomeji Unto update for di Super Eagles bonus marra, say, Federal Government don  agree to  approve money for di Super Eagles match bonus wey concern AFCON 2025. Minister of State for Finance, Doris Uzoka-Anite, tuk say players go begin see di money for dia bank accounts from today or tomorrow. Before now, Super Eagles players bin threaten say dem no go travel for dia quarter-final match because allowance […]

todayJanuary 8, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app