News-edi 1

2502 Results / Page 13 of 278

Background

OBODO NAIJA

Nigeria Tell South Africa Make Dem Stop Xenophobic Attacks

Nigeria don call on South Africa to take urgent action to stop di repeated xenophobic attacks against Nigerians and other African nationals. Minister of State for Foreign Affairs, Sola Enikanolaiye, tuk dis one during a meeting with South Africa's Minister of International Relations and Cooperation, Ronald Lamola, for Abuja. Enikanolaiye say President Bola Tinubu direct di meeting because di attacks dey threaten di long-standing relationship between both countries. He also […]

todayJuly 29, 2026 15

Lagos

Lagos Dey Plan Special Number Plates For Pipo Wey Get Disability

Lagos State Gornment don begin plan to introduce special vehicle number plates for people wey get disability, so movement fit easier and everybody fit enjoy equal access across di state. According to statement from di state gornment, Lagos State Office for Disability Affairs, LASODA, and Lagos State Motor Vehicle Administration Agency, MVAA, na dem dey work together to bring di plan to life. Di idea come after LASODA management visit […]

todayJuly 29, 2026 14

Sports

Cucurella Draw Spain Coachie Face On Top Him Body

Spain defender, Marc Cucurella, don honour World Cup-winning coach, Luis de la Fuente, by drawing di coach tattoo for him body after Spain win di World Cup. Cucurella help Spain beat Argentina 1-0 for di final, as De la Fuente lead di team to another international trophy. Di Real Madrid defender reveal di new tattoo for social media after him £52 million move from Chelsea in June. Di tattoo show […]

todayJuly 29, 2026 13

obodo oyinbo

South Africa See Shege As Migrants Comot

South Africa dey face serious labour shortage after thousands of foreign workers leave di country because of anti-migrant attacks and tighter immigration enforcement. According to One Zimbabwean farmworker wey porpoly dis mata, Aaron Majatamhe, say plenty fruits and grapes still dey for farms because no enough workers dey to harvest them. Di shortage don affect farms, factories and even homes, as employers now dey struggle to find workers. Reports show […]

todayJuly 29, 2026 13

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Tuk Say Naija Economy Dey Improve

Wi oga Presido, Bola Tinubu don rake again, say if bad belle pipo like, make dem tuk from now  till tomorrow, dat wetin im knw be say Naija economy don bunch back like bounchy bounchy cattle. Na oga  Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, mouth naim yarn dis one on Tuesday after e lead di National Communications Team go meet di Presido for wi decision headquaters. According to […]

todayJuly 29, 2026 16

Lagos

Lagos Tighten Safety Rules for High-Rise Buildings

Lagos State Gornment don carry mata for head  dey hawk Lagos problem, say, di way building take collapse don too much, and like dis na to “protesion” every every for di obodo Lagos naim be di goal. Small tin, person go hear, one building don collapse, if nor be building na fire as dem ginger all lagosians to dey very careful with dia safety. Na di oga kpatakpata, Director-General of […]

todayJuly 29, 2026 15

OBODO NAIJA

Enugu Air CEO Clear Air On Top Di Benin Airport Incident

Chief Executive Officer of Enugu Air, Captain Tolu Ita, don clear di air say di recent runway incident for Benin Airport no be plane crash or emergency landing, as all passengers and crew members come out safe. For video wey di airline post on Friday, she tok say di aircraft slide comot from runway after e hydroplane during landing, but nobody sustain injury or die. She explain say di plane […]

todayJuly 24, 2026 19

Entertainment

Cardi B Tok Say Any Son Wey Giv Girl Belle Go Comot for House

American rapper Cardi B don tok say if any of her sons giv girl belle, na di same day na im go tell am make e comot for house. For one video wey she share, Cardi B tok say anybody wey make adult decision suppose ready to carry adult responsibility. She add say her son go need find work, stand on im own financially and take responsibility for wetin e […]

todayJuly 24, 2026 21

OBODO NAIJA

Peter Obi Want Make Dem Touchlight Enugu Air Runway Askident

Peter Obi don show joy after Enugu Air plane run comot from runway as e dey land for Benin Airport, and e thank God say all 68 passengers and crew members come out safe without any injury or death. For statement wey e post for X on Friday, Obi praise di pilot, cabin crew and airport emergency workers for dia fast and professional work wey hellep stop bigger gbege. E […]

todayJuly 24, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds