News-edi 1

1469 Results / Page 19 of 164

Background

Sports

Super Eagles Mash Mozambique 4-0, Enter AFCON 2025 Quarterfinals

By Ebi Oboko Nigeria show beta character hammer Mozambique 4-kondo for Africa Cup of Nations 2025 Round of 16 for Fez, Morocco, comot for quarterfinals. Ademola Lookman score first goal for 20th minute come still assist Victor Osimhen make e double the lead. Osimhen score again for second half, before Akor Adams finish quick counter make am  4-0. Super Eagles dey ginger for their chase of fourth AFCON title as […]

todayJanuary 6, 2026 14

foreign

Maduro Cry Kidnap, as US Drag Am Go Court

By Ebi Oboko Venezuela Presido, Maduro, 63, don go tell one US court for New York say dem kidnap am comot Venezuela, and say e no guilty, as e still dey claim say e be president. Im wife, Cilia Flores, too talk say she no do anything bad, as both of dem appear for court. US commandos carry dem early Saturday, and later President Donald Trump announce say America don […]

todayJanuary 6, 2026 11 10

National

President Tinubu Order Security To Kramp Niger State Jaguda Boys

By Ebi Oboko Oga Presido, Bola Tinubu dey vex seriously don order im olopka, army, vigilante say make dem carry dia rake and fork enter the bushes of Niger state environs to gbab di jaguda boys wey attack communities for Niger State, kill over 40 pipo and kidnap plenty others. For statement wey im sign by imself on Sunday, Tinubu say im don send sms to wi Defence Minister, Service […]

todayJanuary 5, 2026 14 37

Sports

Cameroon Park South Africa Kaya Comot From AFCON, Beating Dem 2-1

By Ebi Oboko Junior Tchamadeu score first for 34th minute, and Christian Kofane add second goal two minutes after half-time, make Cameroon beat South Africa 2-1 for AFCON last-16. South Africa try fight back as Evidence Makgopa score late, but e no reach. Cameroon don enter  quarter-final, wia dem go face Morocco on Friday. Morocco sef beat Tanzania 1 kondo for dia round of 16 game just before the Cameroon […]

todayJanuary 5, 2026 16 17

Sports

EPL Result: Man City, Chelsea Play Draw Open Way for Arsenal

By Ebi Oboko E be like Arsenal don dey peel out with the EPL title beating Bournemouth 3-2, and with plenty wahala result yesterday. Leeds add salt to Ruben Amorim wunjury and Manchester United, drawing 1 1, Matheus Cunha ni score to save United one point. Everton lose 2 4 to Brentford as Igor Thiago run hat trick, while Beto and Barry score for Everton. Newcastle beat Crystal Palace 2 […]

todayJanuary 5, 2026 14 15

Business

Tins Wey You Need Sabi About Di Naija New Tax Law

By Ebi Oboko TO WHO E CONCERN – MAKE I JUST GIVE YOU DIS INFORMATE. QUESTIONS & ANSWERS ON DI NEW NIGERIA TAX LAW (Focus on Individuals and Small Businesses) 🟢 Q1: When Di  new Nigeria Tax Act go start work? A1: Di  new tax law go start from 1st January 2026. 🟢 Q2: Who dis tax law concern? A2: E concern everybody wey dey earn money for Nigeria – […]

todayJanuary 5, 2026 20 14

OBODO NAIJA

Police Carry Joshua Driver Go Court

By: Rilwan Agbomeji Ogun State Police don carry driver of Lexus SUV wey involve for crash with boxing champion Anthony Joshua go court. Dem arraign di driver, Adeniyi Mobolaji Kayode, 46 years old, for Sagamu Magistrate Court on Friday, January 2, 2026. Police talk say dem charge am because of di accident, and di case don officially enter court. According to police spokesman, Oluseyi Babaseyi, di man face four charges, […]

todayJanuary 2, 2026 16

Lagos

Sanwo-Olu Revisit GNI Building, Say 8 People Kpai

By: Rilwan Agbomeji Oga govo of Lagos state, Babajide Sanwo Olu don go back see di extent of damage for di Great Nigeria Insurance (GNI) building on Lagos Island for Balogun market wey burn last wee. Oga govo say so far na 8 pipo dem don confamate dead for di ugly marra. Visiting di site on Friday 2 January, 2026, di govo give a total breakdown of wetin relly hapun […]

todayJanuary 2, 2026 8 2

Sports

Mozambique Presido Promise To Give Players Bonus To Beat Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Mozambique Presido, Daniel Francisco Chapo don hail di Mambas afta dem qualify for di Round of 16 for 2025 Africa Cup of Nations wey dey happen for Morocco. E yarn tori pipo on Friday, say, di team show correct football and make di whole country proud, even though dem lose 2-1 to Cameroon for dia last group match. Chapo say di achievement na big one wey nobody […]

todayJanuary 2, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app