News-edi 1

1366 Results / Page 19 of 152

Background

National

EFFC Boss Drop Yanings Say Corruption Dey Block God Blessings For Nigeria

By: Rilwan Agbomeji Chairmo of EFCC, Ola Olukoyede, don open di secret finally oh, say  na corruption dey block God blessings wey suppose reach Nigeria. Im tuk dis konfam tuk for im Christmas message say, na corruption dey stop di country make e reach full potential. Olukoyede beg Nigerians make dem join hand fight corruption to make Nigeria strong, rich and respected. Im call on everybody make dem waka together […]

todayDecember 25, 2025 10

Lagos

Govnor Sanwo-Olu Give Update On GNI Building Fire

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don break silence on di fire wey shake Great Nigeria Insurance Building for Martins Street, Lagos, oga go see di place, dey beg people make everybody calm down. Sanwo-Olu yarn dis one through Information Commissioner, Gbenga Omotoso, for statement wey im drop Thursday. Sanwo-Olu say emergency teams don control di fire and situation dey under check. Good news be say no single […]

todayDecember 25, 2025 11

Sports

Coach Gamondi Say Tanzania Sabi Ball Pass Nigeria

By: Rilwan Agbomeji Tanzania coach Miguel Gamondi talk say e still dey happy small with how im team play, even though dem lose 2–1 to Nigeria for AFCON match on Tuesday. Na Nigeria score first through Semi Ajayi, before Charles M’mombwa equalise for Tanzania early second half. But celebration no last as Ademola Lookman quickly score winner give super eagles, while Tanzania still dey find dia first AFCON win.   […]

todayDecember 25, 2025 17

foreign

How Yemen Govment & Houthi Agree To Release Thousands Prisoners

By: Rilwan Agbomeji Yemen govment and Houthi group don agree to free plenty prisoners afta about two weeks of peace talk for Muscat, Oman. Dis na according to statement wey UN special envoy Hans Grundberg release. Houthi official Abdulqader al-Mortada talk for statement wey e post on x say dem agree to exchange 1,700 Houthi prisoners for 1,200 govment side, including Saudi and Sudan people.  

todayDecember 25, 2025 8

National

Suicide Bomber Kill 5, Injure 35 For Ngamboru Market Mosque, Maiduguri

By: Rilwan Agbomeji Five people don kpai and 35 odas don get different kain injury afta one teen suicide bomber blow imself for mosque inside Ngamboru market, Maiduguri, during evening prayers on Wednesday. Eyewitness talk say di blast happen around 6:10pm when plenty traders dey worship before dem go house, and e make fire plus thick smoke burst for mosque ceiling. Di explosion scarra wetin nor good for di crowded […]

todayDecember 25, 2025 10

National

First Lady Remi Tinubu Share Christmas Food For Kaduna

By: Rilwan Agbomeji Nigeria first lady, senator Oluremi Tinubu, don flag off food distribution for Christmas and New year celebration for Kaduna, as she donate ₦100 million to Christian Northern Nigeria political forum. She praise di office of di senior special assistant to di president on political and other matters for arranging di programme, and reveal say Alhaji Ibrahim Masari provide 48,000 bags of 25kg rice plus transport money for […]

todayDecember 25, 2025 8

Lagos

Fire Trap Traders For Balogun Market Plaza

By: Rilwan Agbomeji An unknown number of traders dey trap inside Great Nigeria Insurance house for Balogun market, afta fire burn di upper floors of di plaza on Wednesday. One eyewitness, wey call imself Sola, talk say di fire start around 4:40 to 5 p.m. For di fifth floor, cause stampede and stop some people from coming out, especially those for top floors. Lagos state emergency management agency confirm say […]

todayDecember 25, 2025 7

National

President Tinubu Set Up APC Peace Committee For 2027 Election

By: Rilwan Agbomeji President Bola Ahmed Tinubu on Wednesday for Lagos don set up APC committee wey go handle strategy, conflict resolution and mobilisation as party dey prepare for 2027 general elections. Di committee get APC govos, ministers and oda big party stakeholders, with Yobe state govo, Mai Bala Buni, as Chairman, while Muiz Banire serve as member and secretary. Oda members include Kwara state govo and NGF Chairman Abdulrahman […]

todayDecember 25, 2025 8

foreign

Two People Kpai As Israeli Drone Strike Eastern Lebanon

By: Rilwan Agbomeji Two people kpai on Thursday as Israeli drone strike hit one minibus for eastern Lebanon, even as ceasefire still dey in place. Lebanon State News Agency NNA talk say di drone hit di vehicle for Hosh al-Sayyed Ali road inside Hermel area. Di attack don raise fresh concern about who break di ceasefire and how di strike take happen. Israeli military spokesman, Avichay Adraee, claim for X […]

todayDecember 25, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app