News-edi 1

2330 Results / Page 21 of 259

Background

south west

Ogun Police Burst Criminal Network, Arrest 6 Suspects, Recover Guns

By : Jolayemi Olajide Ogun State Police Command don arrest six suspects, recover guns, bullets, generators and mobile phones for different operations for Abeokuta, Wasimi and Ibafo. According to di command tuk, tuk, Oluseyi Babaseyi, dat, na dia  Violent Crime Response Unit, SWAT and Ibafo Division naim run di parrol. The suspects wey dem arrest include Afisu Awesu, Bala Aminu, Moruf Sodiq (Okiki), Mumuni Amodu (Stone), Abayomi John (Ibafo) and […]

todayJune 17, 2026 10

Sports

Ekong Confess Say E Still Dey Miss Super Eagles

Former Super Eagles captain William Troost-Ekong don tuk say e still dey miss life with di national team even afta he retire from international football for December 2025. Di 32-year-old defender wey serve Nigeria for about 10 years tuk dis one for podcast roundtable wey him join with players like Ola Aina, Alex Iwobi, Joe Aribo and Calvin Bassey. Ekong tuk say E no regret im decision to retire, but […]

todayJune 17, 2026 8

OBODO NAIJA

Senate Clear Customs Over ₦62bn

Senate Committee on Public Accounts don clear Nigeria Customs Service over allegation say dem no remit ₦62.2 billion enter Federation Account as stated for 2019 Audit Report. Di committee, wey senators lead di touch lighting, take decision after dem hold session with Customs Comptroller-General, Bashir Adeniyi, over 77 audit queries for 2019 and 2020 reports. Dem say dem still go set up ad hoc reconciliation panel to review remaining 76 […]

todayJune 17, 2026 9

National

Labour Unions Para for N70k Minimum Wage

Nigerian labour unions don tell Federal Government say N70,000 minimum wage no reach anywia again because food, transport, and house rent don cost gan. Inside one meeting for Geneva, di unions tuk say dem no go gree make gornment tax dis money or put more load for poor workers body. As di two-year review time dey reach for July 2026, labor leaders dey plan to start tuk sharply with gornment […]

todayJune 17, 2026 12

Lagos

NGO Beg Lagos Assembly Make Dem Protect Justice

One human rights group, Centre for Human and Socio-Economic Rights (CHSR), don write petition go Lagos State House of Assembly, dey ask Speaker Mudashiru Obasa and lawmakers make dem protect di ongoing murder trial wey involve Ajiran community killings for Eti-Osa LGA. Di  group presido, Comrade Alex Omotehinse, say dem dey worry about attempts wey fit influence public thinking and spoil justice for di case. Omotehinse explain say, police before, […]

todayJune 17, 2026 9

Lagos

Police Explain Wetin kpai DCP Khan Salihu

Lagos State Police Command don clear air say story wey bin dey fly say late DCP Khan Salihu dem kidnap before im kpai na fat lie from di pit of hell. Police tuk tuk, SP Abimbola Adebisi, explain for statement, say di officer just complain say e no dey well, dem rush am go hospital, naim doctor konfam say e don kpai. Police tuk say di report na fake news […]

todayJune 17, 2026 14

Sports

Mbappé Score Brace As France Beat Senegal

Unto world cup update, France don go show Senegal pepper, wining dem 3-1 for Group I World Cup match wey hapun for New York/New Jersey Stadium on Tuesday. Kylian Mbappé score two goals, including correct long-range strike for 96th minute, take make hin total World Cup goals reach 14 and also become France highest goal scorer with 58 goals. Bradley Barcola con add another goal for France, while Senegal manage […]

todayJune 17, 2026 10

obodo oyinbo

President Trump Promise To End Ukraine War

US Presido, Donald Trump don drop micro soft word after G7 summit wey  hapun for Evian-les-Bains, France say Russia suppose enter peace deal with Ukraine to end di war. Trump tuk for im truth social,  say e don meet President Volodymyr Zelenskyy and other G7 leaders, and e go try do wetin e fit do to stop di war for Ukraine. Trump dey insist say peace nor be wetin dem […]

todayJune 17, 2026 8

OBODO NAIJA

Federal Gornment Need To Fix Nigeria To Avoid Xenophobic

Chairmo of Inter-Party Advisory Council, IPAC and National Chairmo of Allied People’s Movement, APM, Yusuf Dantalle, don clear FG, why dem need learn from di xenophobic attacks for South Africa, say na sign say Nigeria gat build build dia own country. Im yarn dis one for TV sit down tuk on Tuesday,. Dantalle say Nigeria suppose be example to oda African countries, if not say, dem never sti knw demselevs, […]

todayJune 17, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds