News-edi 1

1366 Results / Page 22 of 152

Background

Sports

Troost-Ekong Collect National Honour Certificate From Presido Tinubu

By: Rilwan Agbomeji  Retired Super Eagles captain William Troost-Ekong don receive national honour certificate from Presido, Bola Ahmad Tinubu on Monday. Troost-Ekong announce di receipt for X on Tuesday, say e dey proud for im and im family. Di award na Member of di Order of di Federal Republic (MFR), wey Tinubu giv am for official ceremony. E thank President Tinubu for di honour, call am big recognition for im […]

todayDecember 23, 2025 10

National

Six Rivers Reps Kawasaki Go APC

By: Rilwan Agbomeji Based on di gbege wey dey inside di People’s Democratic Party, anoda set of PDP law makers precisely from Rivers State don buy waka enter di All Progressives Congress. Dis announcement follow di law makers sitting on Tuesday for Abuja. Di law makers include Solomon Bob, Victor Obuzor, Dumnamene Dekor, Cyril Hart, Blessing Amadi and Felix Nwaeke. According to source from di National Assembly, all six of […]

todayDecember 23, 2025 5

Lagos

Sanwo-Olu Swear In Obasa Pikin As Agege LG Chairman

By: Rilwan Agbomeji Lagos Govnor Sanwo-Olu on Monday for Lagos House, Ikeja, swear in Abdul-Ganiyu Obasa as Agege Local Govment chairman. Sanwo-Olu tell am make e face grassroots work and follow Lagos govment plan. Obasa wey be son of Assembly Speaker Mudashiru Obasa bin don dey act as chairman before dem confirm am. Dem also swear in Toyin Adejimiwa as Permanent Secretary same day.

todayDecember 22, 2025 9

National

FG Yarn Say Palava With US Don Clear Well-Well

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don talk say di gbege wey burst between Naija and America don settle well-well. Information Minister Mohammed Idris yarn dis one on Monday for year-end briefing for Abuja. E say Naija handle di mata wella and di talk help both countries lock hands stronger. Di palava start afta US President Donald Trump threaten action over alleged killing of Christians for Naija, but FG say issue […]

todayDecember 22, 2025 7

Sports

Zambia Carry Last-Minute Draw Against Mali For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji AFCON 2025 Group B take enter stage on Monday Afternoon as Zambia and Mali take play 1-1 draw. Mali start sharp from kickoff and create plenty chances, but El Bilal Touré miss big penalty for 41st minute. For 60th minute, Mali finally score when Lassine Sinayoko finish clean from corner move. Zambia no gree loss, Patson Daka later score one mad equalizer wey carry di game enter […]

todayDecember 22, 2025 14

Sports

Tanzania Go Make Match Hard For Super Eagles – Onazi

By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder, Ogenyi Onazi don warn say Tanzania go make life hard for Super Eagles for dia AFCON 2025 Group C match on Tuesday for Morocco. Onazi yarn for TV siddon talk say players gatz prepare well if dem wan collect full three points. Super Eagles dey favourite to top di group wey get Tunisia and Uganda join body.  

todayDecember 22, 2025 9

Sports

We Ready Well-Well To Face Nigeria – Gomandi

By: Rilwan Agbomeji Tanzania coachie Manuel Gomandi talk say im team don ready for AFCON 2025 Group C opener against Nigeria. Dem go face Super Eagles for AFCON first time since 1980. Dem lose 3-1 back then, wey Christian Chukwu lead Nigeria to di African Championship.

todayDecember 22, 2025 7

Sports

Lookman Yarn Say AFCON 2025 Cup Na For Naija

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger, Ademola Lookman don clear marras dat di Super Eagles ready to go di extra mile to collobi di 2025 African Cup of Nations Dis yarnings dey follow fans demand on social media mata say Naija miss out for di 2026 world via penalty to Dr Congo Lookman respond for TV siddon talk dat di team go correct di past by showing correct skills and […]

todayDecember 22, 2025 7

National

Naija And US Sign $5.1bn Agreement To Join Hand For Health Sector

By: Rilwan Agbomeji US don agree five-year health deal with Naija to help di country guide for health matas and boost church hospitals make country health system strong and boost church hospital dem. US Deputy tuk tuk person, Thomas Pigott, yarn dis one wrap am like groundnut send giv news pipo on Saturday. Pigott yarn say US go drop nearly $2.1bn for HIV, TB, malaria, polio plus mama and pikin […]

todayDecember 22, 2025 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app