News-edi 1

1366 Results / Page 23 of 152

Background

National

FG Declare Say Kidnappers And Bandits Na Terrorists

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don cut rope follow say any kidnapper or bandit go face di music just di way dem take dey treat terrorists. Minister of Information, Mohammed Idris na im carry di mata for head as e take serious reach, siddon tori pipo dey tell dem for Abuja how di federal govment ready to wipe out any jaguda boi wey no wan allow Nigeria drink water keep […]

todayDecember 22, 2025 5

National

Presido Tinubu Arrange Nepa Man Dr. Mulisiu Oseni As Nerc Chairmo

By: Rilwan Agbomeji Presido, Bola Ahmed Tinubu don appoint  ogbonge  nepa man Dr. Mulisiu Oseni, as new chairman of di Nigerian Electricity Regulatory Commission afta senate confirm di board members for abuja. Dis one mean say,  presido Tinubu don drop Abdullahi Ramat wey im nominate earlier to replace former Chairman, Sanusi Garba. According to presido tuk tuk persin, Bayo Onanuga, di move na to make sure say strong and effective […]

todayDecember 19, 2025 9

foreign

EU Give Ukraine €90 Billion Loan Say Make Dem Use Am Guide Dia Economy

By: Rilwan Agbomeji Unto marras for di Ukraine war, say like dis, European union don join bodi arrange €90 billion loan for Ukraine say make dem use am take guide, as dia economy dey cry because of war blood. According to report, di Ukraine economy don worwor and that I worwor pass atutuporyoyo Di deal come afta plenty talks for brussels summit, wey Ukraine request more fund because of dia […]

todayDecember 19, 2025 3

Sports

Alonso Dey Fight Make E Still Get Im Job – Tote

By: Rilwan Agbomeji  Former Real Madrid striker, Tote, don yarn say manager Xabi Alonso dey fight to keep im job for di club. Tote yarn dis for one siddon talk show say decision to sack Alonso don almost ready as confidence don low for am. E yarn say Xabi dey struggle every three days to prove himself, and di pressure na heavy for am. According to Tote, some people no […]

todayDecember 18, 2025 12

foreign

Flood Force Thousands To Run Comot For Malaysia

By: Rilwan Agbomeji Bad flood don force thousands to comot from dem house for Malaysia on Thursday. For Pahang state, 8,226 people don waka go temporary evacuation center, up from 3,796 the day before. Johor get 347 people, Terengganu 913, while Kelantan don evacuate 16 people. Flood, landslide, storm, and cyclone don scatter South and Southeast Asia, with Indonesia report over 1,059 dead, Sri Lanka 640, and Malaysia 3 confirmed […]

todayDecember 18, 2025 8

National

Africans No Be Pawn As NAF Men Free For Burkina Faso – Shehu Sani Talk

By: Rilwan Agbomeji Former Kaduna Central Senator, Shehu Sani, don hail di release of 11 Nigerian Air Force men from Burkina Faso. Di release happen afta Burkina Faso military junta led by Ibrahim Traoré free Naija aircraft and personnel. Sani yarn for X say Africans no suppose be pawn for neo-colonialists and imperialists. E also praise Foreign Affairs Minister Yusuf Tuggar diplomatic waka wey make di release happen.

todayDecember 18, 2025 9

National

Kano State Govo Yarn Say E Go Stop Delay For Public Workers Benefits Payment

By: Rilwan Agbomeji Kano State Govo, Abba Yusuf, don yarn say e no go allow public workers suffer delay for their benefits again. Di pledge come Wednesday as e dey pay severance, accommodation, and leave allowance to 1,371 former councillors wey serve between 2021 and 2024. Di payment ceremony hold for Coronation Hall, Government House, Kano, and na di last batch of payment. In total, government don release ₦8.26bn to […]

todayDecember 18, 2025 5

National

NMDPRA, NUPRC Oga Dem Resign As Dangote Petition Shake Sector

By: Rilwan Agbomeji Nigeria petroleum sector don enter gbege as NMDPRA CEO, Farouk Ahmed, and NUPRC boss, Gbenga Komolafe, don resign Wednesday. Di resignations follow wahala wey Dangote Group President, Aliko Dangote, bring up over fuel import, pricing, and regulator wahala for downstream sector. Dangote don accuse Ahmed of economic sabotage and drag matter go ICPC, yarn say regulator spend about $5m for im pikin education for Switzerland. Di shakeup […]

todayDecember 18, 2025 5

Lagos

Fake Lasu Result Land Lagos College Provost For Jail

By: Rilwan Agbomeji Lagos High Court for Ikeja don knack Adonai Advanced Institute provost, Samson Orijugo, three years jail for faking LASU result. Justice Modupe Nico-Clay yan say Orijugo forge LASU letter make e look like im school get link with university, but na lie full ground. Di fake letter go one student, John Chibuzor Okoro, wey make am think say im dey attend LASU-affiliated school. Court yarn say Orijugo […]

todayDecember 18, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app