News-edi 1

2502 Results / Page 22 of 278

Background

OBODO NAIJA

Army Burst Gun Runners, Seize Seven Guns for Kaduna

Edited by: Esther Troops of Sector 7, Operation ENDURING PEACE, don intercept one suspected arms trafficking gang for Kaduna State and recover three locally made AK-47 rifles plus four submachine guns wey dem hide inside one vehicle, according to Nigerian Army. Army make dis known for statement wey dem post for dia official social media pages on Tuesday. Dem say di intelligence-led operation happen early Monday morning for Samaru Checkpoint, […]

todayJuly 13, 2026 18

OBODO NAIJA

NUT Cry Out, Say Make Dem Rescue Oyo Headmaster Sharp Sharp

Nigeria Union of Teachers (NUT), Oyo State chapter, don raise alarm over di kidnap of one primary school headmaster for Itesiwaju Local Government Area, as di union dey call for im quick rescue. Di union drop dis one for statement wey State Chairman, Hassan Fatai, and State Secretary, Salami Olukayode, sign and give tori pipo for Ibadan. According to di statement, gunmen kidnap M.K. Owoade, wey be headmaster of Nomadic […]

todayJuly 13, 2026 16

OBODO NAIJA

Soludo Wife Yarn Nigerians To Always Choose Healthy Food

Anambra First Lady, Dr Nonye Soludo, don tell Nigerians make dem dey choose healthy food by eating more local fruits, vegetables, beans, grains and tubers wey get plenty nutrients wey body need, she talk say natural food na one of di biggest gifts God give human beings. Soludo, wey also found di NGO Healthy Living with Nonye Soludo, say when people choose natural food instead of plenty processed food, e […]

todayJuly 13, 2026 11

OBODO NAIJA

Aisha Buhari Show for Late Husband One-Year Remembrance

Former First Lady Aisha Buhari don attend di one-year remembrance of her husband, former President Muhammadu Buhari, wey hold for Abuja on Monday. Muhammadu Buhari, wey rule Nigeria as President from 2015 reach 2023, die on July 13, 2025, for London at di age of 82 after long illness. Dem later bury am for im hometown, Daura, Katsina State, according to Islamic rites.

todayJuly 13, 2026 20

obodo oyinbo

Heatwave Kpai 2,700 People for England, Wales

By : Jolayemi Olajide Person wey dey naija, and other part nor knw wetin God do for am, say like dis, at least 2,700 pipo kpai for England and Wales because of serious heatwaves wey hapun for May and June. According to research wey dem package for Imperial College London, heat wave don make pipo get igbeke, na so dia body dey red, u knw oyinbo na, e be like […]

todayJuly 13, 2026 11

obodo oyinbo

Federal Gorment Match break say no to WAEC AND NECO Increase Reg Fees

By : Jolayemi Olajide Finally, small air don enter di room as di Federal Ministry of Education announce on Monday say dem go wait, dat dem nor dey increase WAEC and NECO registration fee to 50k. Everywia first blur when mehnmehn wak up on Monday hear say dem don increase WAEC and NECO fee, na so dragging start across di obodo Nigeria. Officials inside Abuja code dis suspension because dem […]

todayJuly 13, 2026 16

OBODO NAIJA

INEC Open Online Portal For 2026 Voters Card Registration!

By: Jolayemi Olajide The Independent National Electoral Commission, INEC, don reopen open online portal for Abuja make all Naija pipo fit register for their 2026 voter's card from anywhere. Di process na, na for Pipo go just log enter di internet portal fill dia correct details, and di address wey dem put for there na im dem go use deliver the Permanent Voter's Card, PVC, straight to their door. INEC […]

todayJuly 13, 2026 26 4

National

INEC Shift Deadline for Presidential, NASS Candidate List

By Ebi Oboko Independent National Electoral Commission (INEC) don extend di deadline for political parties to submit names and credentials of candidates wey go contest 2027 presidential and National Assembly elections. Di electoral body say parties now get until midnight on Tuesday, July 14, instead of di earlier Saturday, July 11 deadline. According to INEC, di extension follow appeals from some political parties wey complain say dem face challenges to […]

todayJuly 12, 2026 17 16

Sport Yarns

Senegal Sack Coach Pape Thiaw After World Cup Crash

Edited By Ebi Oboko Senegal don sack dia head coach, Pape Thiaw, after di team crash comot for Round of 32 for 2026 FIFA World Cup. Senegal Football Federation tok say dem don sack Thiaw and all di coaching crew after executive committee meeting on Sunday. Di federation presido, Abdoulaye Fall, go address journalists on Monday to explain why dem take di decision and wetin dey next for di national […]

todayJuly 12, 2026 14 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds