News-edi 1

1730 Results / Page 25 of 193

Background

Lagos

How LASEMA Take Save Lives For Ogba School Building Collapse

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don tell residents not to fear after one four-storey building collapse for Ogba. Say dia quick action save plenty students and workers for one Comprehensive College, wey dey 11 Adudatu Street. According to report, dem see school bags, computers, and oda tins scatter for ground, plus two cars wey dey trapped under rubble. LASEMA say dem monitor di building early an even send  warning, […]

todayMarch 11, 2026 6

Lagos

Lagos Assembly Agree To Committee Report On Makoko, River Community  Demolitions

Lagos State House of Assembly  don accept di sugestion wey dia Committee on Rules and Business give about di demolitions wey hapun for Makoko, an oda areas. Chairmo of di Committee, Hon. Noheem Adams,  say di demolitions don displace plenty people, including elderly, sick, women, and children, and destroy their homes and properties. Im explain say di Committee come to dis conclusion after five meetings with di affected people and […]

todayMarch 11, 2026 5

Lagos

Lagos Speaker Obasa Receive Appointment From Commonwealth

Speaker of di Lagos State House of Assembly,  Mudashiru Ajayi Obasa, don get appointment as Sub-National Representative for di Commonwealth Parliamentary Association African Executive Committee. Clerk of di House, Barr. Olalekan Onafeko,  na im read di letter on di floor of di Assembly in Lagos on tuesday, officially notifying lawmakers say Obasa go serve from 2026 reach 2029. Di letter tuk say Obasa go start im tenure by attending di […]

todayMarch 11, 2026 6

Lagos

Lagos Govo Sanwo-Olu Unveil IBILE Youth Ambassadors

Lagos State Gornment don promise say dem go still dey support youth leadership, community development and civic engagement for di state. Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu tuk dis one Tuesday when dem unveil IBILE Youth Academy State and Divisional Ambassadors for Lagos House, Ikeja. Fifty youths show for di event, six of dem come from Ikeja, Badagry, Ikorodu, Lagos Island and Epe, and one go be State Youth Ambassador. Sanwo-Olu  sti […]

todayMarch 11, 2026 11

Lagos

IGP Disu Vow To Boost Police Power For Kwara State

Inspector-General of Police, Olatunji Ridwan Disu, say im go do everything wey dey im power to make police operations strong and stop bandits and kidnappers for Kwara State and across Nigeria. Disu talk dis one on Monday, when im visit Kwara State Police Headquarters for im first operational visit since dem appoint am as IGP. According to am, the visit na to meet police officers and important stakeholders for different […]

todayMarch 10, 2026 7

OBODO NAIJA

NRC Touch Light How Jaguda Boys To Beat UI Lecturer

Di Nigerian Railway Corporation (NRC) say, dem go investigate, after dem hear say Jaguda boys beat lecturer for University of Ibadan, Dr. Mikail Abdussalam, for Obafemi Awolowo Train Station, Moniya, Ibadan. NRC Managing Director, Dr. Kayode Opeifa, put for statement on Tuesday say, harassment or any bad treatment of passengers no dey acceptable railway business. Opeifa say anybody wey do anyhow wey dem catch go face disciplinary action according to […]

todayMarch 10, 2026 4

Lagos

Lagos CP Tell Police Recruitment Team To Dey Fair

Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, don wire beta call to im recruitment team say make dem dey open, with dia new recruit, ensure fairness and integrity. Jimoh talk dis one during meeting with di officials wey dey handle recruitment exercise for di police. Say di exercise na part of nationwide recruitment for 50,000 constables for Nigeria Police Force.

todayMarch 10, 2026 5

Lagos

How Eko Strike Force Recover 111 Guns for Lagos

Eko Strike Force say dem don recover not fewer than 111 different firearms from different parts of Lagos State within di last one year. Oga Commissioner of police, Olohundare Jimoh  ni dey conversate dis one, on Monday during di commissioning of di unit headquarters for Eko Strike Force for Soomolu. Di police boss say di unit sef go hellep  support di work of di Rapid Response Squad to rascal jaguda […]

todayMarch 10, 2026 4

Lagos

Deputy Govo, Hamzat Ginger Boys To Repent For Ramadan And Lent

Lagos State Deputy Govo, Dr. Kadri Obafemi Hamzat, don advise Nigerians make dem use Ramadan and Lent period to repent, reflect, and restore family values. E tuk am during di 19th Annual Ramadan Lecture for Idado, Ibeju-Lekki. Say, true peace na when person obey God and respect im neighbor. Hamzat press tuk say wahala for society, like insecurity and distrust, can only hapun when pipo fail to obey dia Qur’an, […]

todayMarch 10, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app