News-edi 1

1366 Results / Page 26 of 152

Background

Sports

Lookman, Ajayi, Osayi-Samuel Reach Super Eagles Cairo Camp

By: Rilwan Agbomeji Atalanta winger Ademola Lookman,  defenders Semi Ajayi plus Bright Osayi-Samuel don touch Super Eagles camp, Cairo, to jim jim di bodi ahead of AFCON 2025. Fresh faces like goalkeeper Amas Obasogie, Tochukwu Nnadi, and Igoh Ogbu also don report for duty, ready to join di squad. Dem join forces with Francis Uzoho, Stanley Nwabali, Ebenezer Akinsanmiro, and Fisayo Dele-Bashiru, wey don already dey camp. With everybody now […]

todayDecember 15, 2025 8

National

Court Clean Room For Wi Former Minister Ngige For Kuje Prison

By: Rilwan Agbomeji Now make we comot body enter court, wia wi Former Labour Minister, Chris Ngige, deny all di 8 charges wey EFCC put for im head, for Abuja High Court and dat im carry ₦2.2 billion contract give family and friends. Di Minister say walahi im nor do anything like dat. Justice Maryam Hassan talk say make Ngige rent one room for Kuje Correctional Centre since im dey […]

todayDecember 12, 2025 13

Sports

Slot Say Im Sti Want Salah For Liverpool

By: Rilwan Agbomeji Liverpool manager, Arne Slot say  liverpool marraigae with Salah never sti finish normal, and that im go sit down Salah tuk mata as e dey be. U sabi say Salah, wey be 33 years old, vex say dem leave am out of di Champions League game against Inter Milan afta Liverpool draw 2-2 for Leeds, and e complain say e dey throw under di bus by di […]

todayDecember 12, 2025 20

National

Dangote Reduce Fuel Price Again To N699

By: Rilwan Agbomeji E nor possible e nor possible, like dis, like dis, Dangote petroleum refinery don reduce petrol deport price from n828 to n699 per litre, to make life go wiliwere for common Nigerian. Di latest reduction sharply drop (gboza for ground),  afta Chairmo, Aliko Dangote  do two aside with wi Oga Presido Bola Ahmed Tinubu package one or two on  friday, and dat, di reduction go continue go […]

todayDecember 12, 2025 16

National

APC Officially Arrange Office For Fubara As New Member

By: Rilwan Agbomeji Di All Progressives Congress for Rivers State branch, don officially set table for oga Govo Siminalayi Fubara as di newest member wey Kawasaki from di PDP to APC. Like dis like dis , di state APC Chairmo Tony Okocha carry di mata for head like say na government work dey share share di govo left, right and center on top social media , dis one happen for […]

todayDecember 12, 2025 18

National

Maryam Sanda Death Ruling Stay As E Be

By: Rilwan Agbomeji Supreme Court no change mouth, dem uphold di death sentence wey Maryam Sanda collect. Di court, for a 4–1 decision, confirm say nothing dey to change di original judgment. All di grounds wey she take appeal, dem cancel am and call di case empty. Justice Moore Adumein, for di lead verdict, confirm say prosecution show enough evidence to nail di matter.

todayDecember 12, 2025 8

Sports

Udeze Question Super Eagles Final Squad For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji Former Super Eagles star Ifeanyi Udeze don talk say di final 28-man squad wey Nigeria release for AFCON 2025 get many questions wey never receive answer. Di final list drop on Thursday and e spark plenty debate for football circles. Nigeria pick three goalkeepers, eight defenders, eight midfielders and nine forwards for di tournament. Udeze say di selection still raise eyebrow and Nigerians deserve clearer justification.  

todayDecember 12, 2025 8

National

Senate Clear Fani-Kayode, Omokri, Ikpeazu, Ex-INEC Chair, Others For Ambassadorial Posts

By: Rilwan Agbomeji Di Senate Committee on Foreign Affairs turn to small theatre as dem screen Fani-Kayode, Dambazau, ex-INEC oga Yakubu Mahmood, Florence Ajimobi, Reno Omokri and di rest for ambassadorial positions. As senior men waka enter di meeting, all di ambassador wey dem wan screen take di bow but Omokri batch reach na so everywhere catch fire between Senator Mohammed Ali Ndume and Senator Adams Oshiomhole.

todayDecember 12, 2025 10

National

INEC Show Report Card Say Voter Registration Hit 2.6 Million

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don announce say over 2.6 million Nigerians complete dia voter registration for di first phase of di Continuous Voter Registration wey end on December 10. INEC Chairmo, Prof. Joash Amupitan, talk dis one for Abuja, and im say more than 1.5 million people register online while about 1.1 million do physical capture. Im add say di highest turnout come from Osun, […]

todayDecember 11, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app