News-edi 1

1370 Results / Page 35 of 153

Background

National

Jonathan Brief Tinubu On Guinea-Bissau Wahala

Former Presido Goodluck Jonathan don land for Aso Rock to give Presido Tinubu full gist of wetin shelle for Guinea-Bissau election, as tradition demand anytime former presido handle regional wahala. Jonathan talk say di election don already finish, results dey almost complete, and di only correct next step na to announce who truly win instead of dis confusion wey don drag military enter matter. E beg ECOWAS leaders make dem […]

todayDecember 1, 2025 14

National

Atiku Demand Make Dem Probe N17.5tn Pipeline Security Money

Former Vice Presido, Atiku Abubakar don drag President Bola Tinubu gornment for Abuja on Sunday, say how dem spend N17.5tn on pipeline security and related wahala for just one year. Na for inside statement wey dem wrap like moi moi through di Atiku news waka waka dem, on Sunday, in yanyanpu dis one say,  di money pass 12 years wey Nigeria dey pay fuel subsidy wey dey help millions of […]

todayDecember 1, 2025 6

National

Taraba Governor Go Meet Tinubu For Aso Rock

Taraba Governor Agbu Kefas don go Aso Rock to meet Tinubu for closed-door session, E waka enter inside di Presidential Villa around 2pm on Monday. Dis na im first visit since e dash PDP goodbye join APC, and e waka enter di State House with APC National Chairman, Prof. Nentawe Yilwatda. Kefas cancel im APC welcome wey suppose hold November 19, say e no make sense to celebrate while Kebbi […]

todayDecember 1, 2025 5

National

FG, Asuu Don Enter Talks On 40% Pay Rise

Na wah o! Federal Gornment don yarn say dem wan give ASUU lecturers 40% salary increase, according to di pipo wey follow tori pipo talk for Abuja. Dis one land as ASUU leaders dey ready to waka back go negotiation table with Federal Gornment team wey Yayale Ahmed lead, afta dem don finally settle matter and hammer deal for ASUU National Executive Council meeting for Abuja last Sunday. Branch leaders […]

todayDecember 1, 2025 7

National

FG Go Soon Name People Wey Dey Finance Terrorism

Di Special Adviser to President Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, don drop bombshell say Federal Government go soon expose di big men and networks wey dey pump money into terrorism for inside Nigeria. Bwala yarn for TV sit don talk say Tinubu administration don dey take heavy, far-reaching security decisions, and Nigerians go soon see clearly who dey sponsor, shield and empower terrorists across di country. E add say […]

todayDecember 1, 2025 12

Sports

Mikel Obi – “I No Go Allow Corruption Follow Me, I Wan Run NFF”

Former Super Eagles captain, John Obi Mikel, don yarn say e wan take leadership role for Nigeria Football Federation (NFF), but e clear say e go only enter di position if di system clean and no corruption dey. Di 37-year-old football legend talk say Nigeria wey no qualify for FIFA World Cup show say plenty wahala dey inside Nigerian football wey pass di pitch, and e believe say na total […]

todayNovember 28, 2025 21

Sports

EPL – Awoniyi, Aina No Go Play As Nottingham Forest Take On Brighton

Super Eagles duo Ola Aina and Taiwo Awoniyi no go show face as Nottingham Forest battle Brighton on Sunday for Premier League. Awoniyi still dey struggle with knee injury wey make am miss Forest clash with Liverpool last weekend, even after e just return to full training from serious abdominal injury earlier dis year. For Aina matter, manager Sean Dyche don still cast doubt on di defender return, even though […]

todayNovember 28, 2025 9

Sports

“We Gats Focus” — Arokodare Ahead Of Wolves vs Villa Derby

Wolverhampton Wanderers striker Tolu Arokodare don talk say di team gats ready to fight for win as dem face Aston Villa for di West Midlands derby. Wolves don collect only two points from 12 Premier League games dis season, and Rob Edwards’ side dey desperate to grab dia first league win against Villa. Arokodare yarn say even though di match get extra weight as local derby, im wan remove pressure […]

todayNovember 28, 2025 12

Sports

Mbappé Join Cristiano Plus Two More Real Madrid Legends For Special List

Real Madrid don dey suffer small wahala as e dey happen anytime Kylian Mbappé no fit score. After im start di season well, e jam small dry patch wey coincided wit three game wey dem no fit win. Na so pressure start dey build for team, but Mbappé show up for di big match against Olympiacos. After Real Madrid fall behind for Athens, di French star switch things up gbagam, […]

todayNovember 28, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app