News-edi 1

2593 Results / Page 37 of 289

Background

OBODO NAIJA

France Go Face Morocco as World Cup Quarter-Final Wahala Begin

France go face Morocco on Thursday for one heavyweight World Cup quarter-final clash as di tournament don enter di business end. After one month of action wey produce 280 goals in 96 matches, only eight teams remain, all chasing di World Cup trophy wey go be decided on July 19 for East Rutherford. France, wey many people see as one of di strongest teams for di tournament, go meet Morocco […]

todayJuly 9, 2026 25 7

OBODO NAIJA

Mulade Call for Envirnomental Emergency as Oil Spill Dey Affect Delta Communities

Chief (Comrade) Mulade Sheriff, one environmental rights and peace advocate from Delta State, don urge di Federal Government, Delta State Government and all relevant regulatory agencies to sharpaly declare environmental emergency over one major oil spill wey allegedly don affect many host communities for Warri South-West and Burutu Local Government Areas of Delta State. For one statement wey e release on Wednesday, Mulade describe di incident as serious environmental disaster […]

todayJuly 9, 2026 36 4

Articles

LAGOS POLICE ARREST 135 SUSPECTED CULTISTS, VEHICLES WITHOUT PLATE NUMBERS

Lagos State Police Command don send strong warning to youths wey still dey see cultism as achievement instead of shame after them arrest 135 suspected cultist for different part of lagos on Monday night wey dem believe say gather because of cult initiation. Police say all di suspects wey dem parade no be people wey dem carry from dia bedroom. According to dem, na during coordinated raids for different black […]

todayJuly 8, 2026 22

OBODO NAIJA

Tension Dey For Ojoo Area of Ibadan

Tension don rise for Ojoo area of Ibadan, Oyo State, after clash burst out between some groups of residents on Wednesday. According to reports, di fight involve people wey dem say come from Yoruba and Hausa communities, although authorities never officially konfamate wetin really happen as at di time of dis report. Officials of Operation Burst, di joint security outfit for Oyo State, don reportedly near di area to restore […]

todayJuly 8, 2026 29

Sports

Zeki Amdouni Fit Retire From Professional Football Dis Week

Switzerland star, Zeki Amdouni, don yarn say he fit retire from professional football once he face Lionel Messi for FIFA World Cup. He yarn dis one for him Snapchat on Tuesday after Switzerland beat Columbia. Amdouni joke say after di match, he go just end im football career. Argentina wey be defending champions go jam Switzerland for quarter-final later this week.  

todayJuly 8, 2026 38

OBODO NAIJA

 Naija Senate Clear Im State Assemblies Why Dem Need Pass State Police Law

By : Jolayemi Olajide Di National Assembly dontigthen every every as e take concern security for obodo Nigeria, say make all di 36 State Houses of Assembly to quick-quick approve di bill for state police. Dis move follow di efforts wey oga Presido Bola Ahmed Tinubu make to spread policing power to hellep fight jaguda boys Di lawmaker press yans, say true, true, Nigeria need state policing. Senate come commend […]

todayJuly 8, 2026 21

OBODO NAIJA

News House of Representatives scata as lawmakers clash to summon President Tinubu

By : Jolayemi Olajide Di House of Representatives bin turn to warzone on Wednesday after lawmakers quarrel sake of one motion wey dey ask make President Bola Ahmed Tinubu come explain him side for di Green Chamber. Benedict Etanabene wey be lawmaker for Delta State bin raise di issue because of one circular wey di Accountant-General Shamseldeen Ogunjimi send out on June 29. Etanabene argue say di matter too serious […]

todayJuly 8, 2026 12

Articles

KONFAM FM DO JOINBODY COLLABO WITH MINISTRY OF HOUSING

One ogbonge proverb yarn say, House wey dem no finish, fit become hideout for wahala or Jaguda boys" and na di same message Lagos State Ministry of Housing carry come today as Konfam FM 89.5 pay dem courtesy visit for Alausa, Ikeja. For di meeting, di permanent secetary of di ministry Engr. Abdulhafis Gbolahan Toriola call on Konfam FM make e join hand with government to educate Lagos residents on […]

todayJuly 7, 2026 30

Local

Delta Commissioner of Police Punish Two Police Officers

By: Yusuf Abuh Two police officers don chop beta koboko for Delta State, don lose dia rank after dem find dem guilty of extortion and other misconduct ontop one viral video. For di viral video di police dey collect kpaje with POS from motorist through POS Delta Police tuk, tuk, SP Bright Edafe, konfam dis development say Commissioner of Police, CP Yemi Oyeniyi, approve di punishment after orderly room trial. […]

todayJuly 7, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds