News-edi 2

1832 Results / Page 13 of 204

Background

Lagos

Sanwo-Olu Declare Small State of Emergency On Top Dorti Mata for Lagos

By: Ayobami Dada Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don declare wetin e call “small state of emergency” for waste management across Lagos. Sanwo-Olu declare dis one as e dey inspect Olusosun dumpsite for Ojota, where Deputy Govo, Dr Obafemi Hamzat, and Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, follow am go. Di inspection na to find out di problem wey dey affect work for di dumpsite and hin kon […]

todaySeptember 10, 2026 7

Sports

Lionel Messi Wan Buy Majority Share For Spanish Club

By: Mariam Ajayi Football star Lionel Messi dey set to become majority owner of Spanish second division club, Eldense. Di deal still dey wait for legal processes, due diligence and approval from Spain National Sports Council before e fit complete. If everything go through, Eldense go become di second Spanish club wey Messi invest inside, after e acquire fifth-tier Catalan club Cornella for April. Messi recently retire from Argentina international […]

todaySeptember 9, 2026 8

OBODO NAIJA

Federal Gornment Release Allowance For Lecturers

By: Mariam Ajayi Federal Gornment don release  CATA for lecturers across federal universities, polytechnics and colleges of education, covering January to August 2026. Education Minister, Dr Tunji Alausa, announce dis on Wednesday for Abuja after e inaugurate di Ministerial Committee on Accreditation, saying di payment follow di 2025 agreement between FG and ASUU. Di allowance dey help academic workers buy tools and materials wey dem need for teaching, research and […]

todaySeptember 9, 2026 10

OBODO NAIJA

Education Minister Hail NYSC, Say Tech Dey Fight Fraud

By:  Damilola Adekunle Education Minister, Dr Tunji Alausa, don hail NYSC as dem use technology fight fraud and make registration and deployment of corp members sharp. Alausa tok dis on Wednesday for Abuja when NYSC Director-General, Brigadier General Olakunle Nafiu,visit am for office, tok say di scheme don record serious transformation since e embrace digital technology. Di minister tok say although some pipo first resist di move, di Digital change […]

todaySeptember 9, 2026 11

Politics

KNN Vex for Obi Matter, Say Make Dem Check Am

By: Kofoworola Olayinka KNN don condemn di alleged blocking of Peter Obi convoy for Makurdi-Gboko Road as “barbaric, dangerous and totally unacceptable” while e dey travel go Yelwata to sympathise with victims of recent attacks. Videos wey dey circulate online show some youths carrying sticks and blocking di road, forcing Obi convoy to stop as di former Anambra State gofnor dey head to di community. Obi allege say an aide […]

todaySeptember 9, 2026 13

obodo oyinbo

Iran Say US Hit Dia Oil Tankers, Warns of Regional Gbege

By: Kofoworola Olayinka Iran Foreign Ministry don condemn US strikes on Iranian oil tankers on Wednesday, saying di attack threaten peace and security for di region. Di ministry say di US action against Iranian commercial vessels go increase tension for di region and pose serious danger to regional and international security. Iran also claim say dia forces attack US military facilities across di region as part of self-defence after di […]

todaySeptember 9, 2026 9

Lagos

LAWMA Tell Lagos People: No Buy for Roadside

By: Kofoworola Olayinka LAWMA don warn Lagos residents say anybody wey buy goods from illegal roadside traders fit face arrest and prosecution, as enforcement go start next week. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, give di warning on Tuesday for di authority headquarters for Lagos, saying di move na to stop illegal trading, waste dumping and blockage of public spaces. E say residents wey buy from traders for roads, medians, […]

todaySeptember 9, 2026 12

Politics

PDP Say Dem No Send Anybody Challenge Osun Election

By: Kofoworola Olayinka PDP don deny say di party authorise or sponsor di petition wey dey challenge di August 15 Osun gofnorship election result, as party spokesperson Mohammed tok dis. Mohammed say di party don publish disclaimer for major national newspapers and identify lawyer Ochai Jacob Otokpa as di person wey purportedly file di petition in PDP name without dia approval. E challenge di lawyer to show any written instruction […]

todaySeptember 9, 2026 11

Politics

Igbo Group Give Benue Govo 24 Hours to Gbab Obi Blockers

By: Kofoworola Olayinka Igbo Heroes and Icons Foundation don give Benue Gofnor Hyacinth Alia 24 hours to identify and arrest suspected thugs wey allegedly block Peter Obi convoy for Makurdi-Gboko Road on Tuesday. Di group say Obi dey enter Benue to sympathise with families wey lose loved ones for Yelwata killings, but youths carrying sticks and other objects reportedly stop am and force am turn back go Plateau State. Foundation […]

todaySeptember 9, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds