News-edi 2

1844 Results / Page 131 of 205

Background

Lagos

Lagos-Ibadan Expressway Askident Pai Three, Wunjor One

By: Esther Ayoola FRSC, Ogun branch don Konfam say three kpai, while one wunjure for road askident wey happen on Sunday for Lagos-Ibadan Expressway. Dis na according to FRSC Sector Command for Ogun State tuk, tuk person, Odunsi Afolabi, Afolabi explain say di crash hapun around 1:04 p.m. for Oniworo area, and e involve eight Men Explaining di askident say na one blue Lexus Jeep collide with a black Boxer […]

todayMay 4, 2026 17

Lagos

Lagos Community Cry For Help Say Dem Blackout Wan Finish Dem For Months

By: Esther Ayoola Residents of Aina Aladi Community Development Association for Alagbado, Lagos, tuk say dem dey suffer oh, serious blackout because of faulty transformer. Community leader, Afeez Lawal, naim carry dis mata dey yarn tori pipo on Saturday, Say dem carry mata to Ikeja Electric office, no response. E explain say di transformer misbehave for about three years before e finally break down for December 2025, wey leave over […]

todayMay 4, 2026 18

Lagos

LAWMA Beg Gornment To Arrange Long Term Plan For Lagos Waste Management

By: Esther Ayoola Di Managing Director/CEO of Lagos Waste Management Authority (LAWMA), Dr Muyiwa Gbadegesin, don konfam matas, say Lagos State never sti get proper Waste Management Master Plan. E yarn dis one when e receive European Union and ECOWAS delegation for Ijora Olopa, Lagos. E explain say LAWMA dey push make gornment develop di plan wey go guide long-term waste management, investment, and beta sustainability for di state. Gbadegesin […]

todayMay 4, 2026 18

Sports

Super Eagles Go Camp For Egypt For AFCON 2025

Super Eagles go set up training camp for Egypt next month to prepare for di 2025 Africa Cup of Nations, SCORENigeria report. Di camp go open on Wednesday, 10 December, and di three-time African champions go play friendly match against di Pharaohs of Egypt four days later. Di friendly na part of di team build-up for AFCON 2025 finals, and head coach Éric Chelle dey expected to submit final list […]

todayNovember 28, 2025 30

Sports

Liverpool Dey Find Answers, Arsenal Dey Ready For Chelsea Test

Premier League champions Liverpool dey face serious wahala as dem don lose six of dia last seven league games, and nothing dey show say Arne Slot dey get grip on di situation. Di club don lose nine of dia past 12 matches for all competitions, wey make am clear say na full-blown crisis dey happen for one of di world’s biggest clubs. Di Anfield side dey experience worst run of […]

todayNovember 28, 2025 28

Lagos

LASG, EU Rolac Dey Push Restorative Justice To Reduce Prison Congestion

Lagos State Ministry of Justice, together with European Union funded Rule of Law and Anti Corruption (RoLAC) programme, don call on people of di state make dem adopt restorative justice to help reduce congestion for correctional centres and lessen di burden on courts. Di appeal come during 2025 International Restorative Justice Week, tagged: “Restorative Justice, Your Legal Rights,” wey hold for Lagos State Ministry of Justice. RoLAC Project Coordinator, Ajibola […]

todayNovember 28, 2025 22

National

FG, States Gats Provide Free Schooling, Lagos Court Don Talk

Federal High Court for Lagos don rule say Federal Government, di 36 states, and di Federal Capital Territory get legal duty to provide free, compulsory, and universal basic education for all pikin wey dey primary and junior secondary school age. Justice Daniel Osiagor deliver di judgement on 9 October 2025 after human rights lawyer Femi Falana (SAN) and Hauwa Mustapha file di case on behalf of demself and di Alliance […]

todayNovember 28, 2025 21

Sports

Amuwogames 2025 Dey Push Grassroots Development

Di 5th edition of AmuwoGames don show say grassroots sports dey very important for discovering and training young talent for Lagos communities. Seun Ayeni, di founder and chief convener of AmuwoGames, talk say na grassroots engagement go help find hidden sporting stars. Ayeni yan for Iman College wey be venue of di event say, “If we no go deep to di grassroots, if we no touch di grassroots, we no […]

todayNovember 28, 2025 23

Sports

Iran Go Boykot 2026 World Cup Draw Sake Of US Visa Wahala

Iran don yarn say dem no go attend next week World Cup finals draw wey go happen for Washington after United States refuse give visa to some members of dia delegation, di Iranian football federation yarn on Friday. Dem talk say di decision no concern sports at all, so di members of Iranian delegation no go participate for di World Cup draw. According to Iranian sports site Varzesh 3, US […]

todayNovember 28, 2025 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds