News-edi 2

1844 Results / Page 129 of 205

Background

Sports

How Rangers Coachie Ilechukwu Jinger im to Players Not to Lose Focus

By: Esther Ayoola Enugu Rangers coachie, Fidelis Ilechukwu don tell im players to stay focus as dem push for Naija Premier Football League title. Rangers beat Bayelsa United 2-0 away for Samson Siasia Stadium on Sunday to remain top of di table. Chidiebere Nwobodo naim score di first goal while Godwin Obaje seal di win with him 12th goal of di season. Ilechukwu tuk say di win important but dem […]

todayMay 5, 2026 16

National

Jonathan Hail Yar’Adua 16 Years After Im Buy Waka Go Di Land Of No Return

By: Jolayemi Olajide Say you nor dey know di value of person until u lose am, and dat na di situation of Nigeria as Former Presido, Goodluck Jonathan pay tribute to late Presido, Umaru Musa Yar’Adua marking 16 years remembrance since e kpai. Jonathan Sukuli dis one for im social media post, dat true, true, Naija dey Miss Yar Adua. Dat Yar’Adua na true servant leader wey sabi as “Gentleman […]

todayMay 5, 2026 25 20

Lagos

One Woman Kpai, Four Injured As Two Sienna Buses Jam Demselves For Third Mainland Bridge

By: Jolayemi Olajide Say nor be small jogolo sup for Third Mainland bridge as two Toyota Sienna buses jam demselves kpaing one woman and wunjor four other passengers on Tuesday. According to report dis askident hapun for early momo near Iyana-Iworo, and both buses carry full passengers. LASEMA tuk, tuk, Olawale Afolabi, later konfamate dis mata to tori pipo dat emergency team reach di area quick to calm di situation. […]

todayMay 5, 2026 26 3

National

How Galadima Dey Beg Atiku Join Di NDC Opposition Party

By: Esther Ayoola As e dey hot say one big member of Naija Democratic Congress (NDC), Buba Galadima, don dey toast former Vice-Presido Atiku Abubakar make e join dia party to hellep push opposition movement for 2027 election. E yarn dis one for TV sit down tuk on Monday, say like dis di NDC dey grow in Status. For Galadima, say if Atiku nor join, pipo fit hold am responsible […]

todayMay 5, 2026 11

National

PDP Pick Turaki Lead Interim NWC, Vow Say Dem Must Field Presidential Candidate

By: Esther Ayoola Pipos Democratic Parti (PDP) don appoint Kabiru Turaki as chairmo of 13-member interim National Working Committee follow dia leadership quanta and Supreme Court judgment. Dem announce am for 103rd NEC meeting for Abuja with support from Seyi Makinde, say moving on, na di new team go handle party matas for now. For him acceptance speech, Turaki tuk say PDP must bring out presidential candidate by force, whether […]

todayMay 5, 2026 17

National

FG Call For Teamwork To Fight Fake News

By: Esther Ayoola Federal Gornment don call, make media, gornment agencies and other stakeholders to do beta collabo to rasca fake news and di speed of wrong information. Minister of Information, Mohammed Idris, tuk dis one for Abuja during 2026 World Press Freedom Day event wey hapun for Radio House. According to Idris, dis anyhow doings of fake news dey reduce pipo trust for gornment and fit scarra national unity.

todayMay 5, 2026 12

National

Abeokuta Cult Clash Kill One, Police Reject Link To Ake Rally

By: Esther Ayoola For Abeokuta, Ogun State, one suspected cult clash don hapun leading to di death of one man. According to Police tuk, tuk, DSP Oluseyi Babaseyi say di fight hapun for Wasimi Ake Road near Centenary Hall and Lotus Bank, as gunshots burst and di jaguda scata, run enter Ijemo Agbadu area. Oke Itoku Division detectives naim con quickly move enter di scene and like dis don start […]

todayMay 5, 2026 17

National

Strike Shut Down University of Ilorin as SSANU, NASU Demand Beta Pay

By: Esther Ayoola Activities for University of Ilorin don stop as workers begin indefinite strike. Say members of Senior Staff Association of Nigerian Universities and Non-Academic Staff Union of Educational and Associated Institutions even gather for peaceful protest for school gate on Monday. Dem carry placards dey demand beta salary, payment of withheld wages, and 45 percent increment instead of 30 percent. SSANU chairmo, Falowo Olushola, explain di strike say […]

todayMay 5, 2026 9

Lagos

Orile-Agege Council Chairmo Empower Local Students 3,000 Exercise Books

By: Esther Ayoola Di Chairmo of Orile-Agege Local Council Development Area, Akinola Idowu, unto love for education don share 3,000 exercise books and other writing materials to support student for im LCDA. According to statement wey Chief Press Secretary, Sunday Adefamoye release on Monday, Idowu run dis mata for im former school, Orile-Agege Community Junior High School, where e finish between 1989 and 1995. Di palliative education support also hapun […]

todayMay 5, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds