Blog horizontal

Background

Sports

DR Congo Ready For 2026 World Cup Play-Off

By: Esther Ayoola Sébastien Desabre, coach of DR Congo national football team, say like dis im boys don dey jim bodi for dia 2026 FIFA World Cup intercontinental play-off. Say Dem go travel to Mexico, play for Guadalajara and Monterrey, join other five countries wey dey fight for di last two spots. DR Congo, wey beat Naija 4–3 on penalties for African play-off final, go face di winner between Jamaica […]

todayMarch 17, 2026 17

Lagos

Deputy Governor Hamzat Tell Civil Servants To Learn Work Well

Lagos State Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, don call on civil servants to show honesty, care, and professionalism. E tuk dis one on Monday for di 60th birthday and retirement thanksgiving service of Permanent Secretary for Office of Deputy Governor, Mobolaji Daba for Chapel of Christ the Light, Alausa-Ikeja. Hamzat say e important, make civil servants sabi dia work, responsibilities, system, protocols, and wetin e need to serve public well. […]

todayMarch 17, 2026 13

Lagos

Sanwo-Olu Launch $25m Fund To Carry 50,000 Out-Of-School Pikins Back To School

Lagos State  Govo, Babajide Sanwo-Olu don release $25 million, Lagos Education Access Fund to hellep enroll about 50,000 pikins wey no dey school enter formal education for di state. Baba govo make di announcement during di unveiling ceremony wey happen for Lagos House Marina. According to di Govo, di Lagos State gornment remain committed to make sure say every pikins for Lagos get access to free and quality basic education.

todayMarch 17, 2026 19

National

President Tinubu To Meet PM Starmer, King Charles For UK

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu like dis don dey arrange im kaya to enter United Kingdom to meet Keir Starmer for bilateral tuk. According to a post by di British gornment, baba Seyi go land UK on March 18 for Windsor Castle, wia Prince William and Catherine, Princess of Wales go welcome am. Say di visit na to strengthen Nigeria-UK relations and show respect to di Queen […]

todayMarch 16, 2026 44

National

Ondo Police Gbab Notorious Cult Leader Bella For Owo

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command don arrest one suspected cult leader wey dem dey call Akinwale Tomiwa for Owo, Owo Local Government Area. Police tuk, tuk, DSP Abayomi Jimoh, say di arrest hapun on Sunday afta Special Anti-Cultism Squad for Akure get correct intelligence. Di Police say Tomiwa, wey pipo sabi as Bella, dey involved for killing of one Rufus Giwa Polytechnic student, Ojo Peter and other crimes. […]

todayMarch 16, 2026 39

National

Osun Govo, Adeleke Accuse APC Of Rigging Election

By: Esther Ayoola Osun State Govo, Ademola Adeleke, say im dey scent foul play, dat di APC dey threaten to use “federal power” run di next governorship election. E yarn dis one for one statement wey im tuk, tuk, Olawale Rasheed, release on Sunday. Adeleke advice di APC to use dia federal power do correct governance, no be to play politics for election. E accuse APC for Osun dat, na […]

todayMarch 16, 2026 14

Sports

France Survive Late D’Tigress Rally, Win 93-86 Points

Nigeria Senior team, di Tigress don finish dia  pre world cup matches with a lose, 93–86 to France for di FIBA Women’s Basketball World Cup Qualifying Tournament wey hapun for Villeurbanne on Sunday. French women, wey dey number three for world, start strong for first quarter and take di early lead. Nigeria tigress show character fight back for second half, even reduce di gap to just two points. However sha, […]

todayMarch 16, 2026 14

Lagos

LASEMA Give Lagos Records For Emergency Handling

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency don share update say, na 173 emergency mata na im don handle between January and February 2026. Permanent secretary, Dr Olufemi Damilola tuk dis one for statement on Sunday as im ma dey share detail of dia operations. Road traffic wahala, ni be di worse according to di permanent secretary, with 56 cases, 53 na normal crash, 3 na bus or car […]

todayMarch 16, 2026 13

Lagos

Senoir Lawyer Falana Drag Gorment Say Monthly Sanitation Dey Illegal

By: Esther Ayoola Human rights lawyer, Femi Falana (SAN), say Lagos State Gornment plan to bring back di monthly environmental sanitation wey go stop people movement for three hours on last Saturday of every month nor make brain at all. Inside news statement on Sunday, Falana say dis plan go cost Lagos wetin nor good and dat na military days doings be dat, an e no suppose dey for democratic […]

todayMarch 16, 2026 12

Lagos

Uber, Bolt, InDrive, Lagride Go On Strike For Lagos

Ride-hailing drivers for Lagos, under Di Union of App-Based Transporters of Nigeria, AUATON, Lagos chapter, say dem go do three-day strike from March 16 to 18. Public Relations Officer, Steven Iwindoye, explain dat, while fares for Uber, Bolt, InDrive, and Lagride never change, cost of living wan kill di living. For di period of di strike, drivers go log off dia apps, and passengers go find am hard to book […]

todayMarch 16, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds