Blog horizontal

Background

OBODO NAIJA

Court Giv 55-Year-Old Woman Bail On Top Turkey Oil Marras

By: Blessing Aminu Chief Magistrate Court No. 1 for Gombe, wey Chief Magistrate Musa-Saleh Kilawa dey stay, don grant bail to one 55-year-old woman, Antine Amadu, wey dey face allegation say she receive stolen property. Amadu, wey dey stay for Dawaki Quarters, Gombe, show for court over allegation say she dishonestly collect one gallon of Turkey oil wey worth N60,000. Prosecution tell di court say di incident happen around 1am […]

todayAugust 31, 2026 16

Politics

IPOB Give Gorment Deadline Over Nnamdi Kanu Appeal

By: Kofoworola Olayinka IPOB don give gorment last warning over sme sme wey dey surround di hearing of Nnamdi Kanu appeal against im conviction. IPOB Directorate of State, DOS, Head, Mazi Chris Nwaogu, issue di last warning on Monday for video broadcast. Dis one come after Nnamdi Kanu family don raise alarm say dem dey delay to hear im appeal and ask make court list di matter immediately. Di family […]

todayAugust 31, 2026 14

Politics

Peter Obi Ask Why Tinubu Wan Hide Im Past Records

By: Kofoworola Olayinka NDC presidential candidate, Peter Obi, don question  Presido Bola Tinubu on why e dey ask foreign court make dem withhold records about im past. Obi raise di matter for statement wey e post for im official social media page on Monday. E say Nigerians deserve answers on matters wey concern public interest, especially issues around di Presido educational records. Obi say sitting Presido suppose get courage to […]

todayAugust 31, 2026 12

crime& security

Bandits Kill Two For Kano, APC Ward Leader Among Victims

By: Kofoworola Olayinka Bandits don reportedly kill two residents for Rantan community, Bebeji Local Gornment Area of Kano State. Di attack happen on Sunday night, when gunmen storm di community and open fire on residents. Residents reportedly run for safety as di attackers unleash terror for di area. One of di victims na Alhaji Garba Buba, wey be APC ward leader for Rantan community. Report say Garba Buba sustain gunshot […]

todayAugust 31, 2026 11

Business

Petrol Price Reach N1,350 For Abuja

By: Kofoworola Olayinka Petrol price don rise reach N1,350 per litre for some parts of Abuja, following different price increases from Dangote Refinery within one week. Checks show say filling stations across FCT don increase dia prices, as motorists dey pay between N1,280 and N1,350 per litre. Dangote Refinery recently increase im gantry price from N1,165 to N1,185, then N1,200 and later N1,265 per litre. Some motorists don complain say […]

todayAugust 31, 2026 11

OBODO NAIJA

FG Set Passport Exercise For Nigerians Wey Dey UK

By: Kofoworola Olayinka Federal Gorment don announce dates and places for special passport exercise for Nigerians wey dey live for United Kingdom. Nigeria Immigration Service go carry out di exercise for London, Manchester, Aberdeen and Cardiff. Di move follow directive from Interior Minister, Olubunmi Tunji-Ojo, plus discussion with Nigerian High Commission and Nigerian communities for UK. Di Nigeria Immigration Service say dem deploy Passport Intervention Team from dia headquarters for […]

todayAugust 31, 2026 8

crime& security

EFCC Recover N1.23trn, $684m And Plenty Other Money

By: Kofoworola Olayinka EFCC Chairman, Ola Olukoyede, don tok say di commission don recover N1.23 trillion, $684 million, £373,905 and €9.34 million between October 2023 and June 2026. Olukoyede yarn dis on Monday while e dey address media executives and journalists for Abuja. E say di money and properties wey dem recover na from financial crimes, with plenty of di naira recoveries wey dem make on behalf of gornment ministries. […]

todayAugust 31, 2026 8

Sports

Obafemi Martins Say Seyi Tinubu Fit Change Niger Football

By: Kofoworola Olayinka Former Super Eagles striker, Obafemi Martins, don tok say Seyi Tinubu, wey be Presido Bola Tinubu pikin, fit help change Niger football if e decide to enter di mata. Martins yarn dis for podcast wey former Super Eagles captain, John Obi Mikel, and Chris Chardy host, wey dem upload for YouTube on Monday. As Mikel ask about di problems wey dey worry Super Eagles and whether di […]

todayAugust 31, 2026 10

OBODO NAIJA

NELFUND Boss Deny Money Wey Dem Use Anyhow

By: Kofoworola Olayinka NELFUND Boss, Akintunde Sawyerr, don deny down allegation say money dey miss for di agency, e tok say nobody get evidence to prove say dem mismanage money. Sawyerr yarn dis one for TV siddon tok on  Monday, saying NELFUND need money to give students loans and say di scheme na part of Federal Gornment plan to redirect money enter welfare programmes. E say make people understand say […]

todayAugust 31, 2026 12

OBODO NAIJA

Defence Minister Say FG Serious About Safer Nigeria

By: Kofoworola Olayinka Defence Minister Gen. Christopher Musa on Sunday, August 30, 2026, don promise Nigerians for obodoyinbo say Federal Government dey serious about making Nigeria safer and secure for everybody. Musa yarn dis wan for meeting with Nigerians wey dey  live for Angola, on di sidelines of African Union meeting for Luanda. E say gornment dey increase soldiers and improve dia equipment and ability to fight security threats across […]

todayAugust 31, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds