Blog horizontal

Background

National

Labour Party Faction Fix May Dates For Primaries

By: Esther Ayoola Nenadi Usman-led faction of Labour Party say dem go conduct presidential primary election on May 23, 2026 ahead of 2027 general elections. Dem make dis one afta dia National Executive Council meeting, where dem also fix May 15, 2026 for governorship, National Assembly and State Assembly primaries. According to dem, dem put di dates to ensure better planning and smooth process.

todayMarch 19, 2026

National

Court Fine EFCC N500k For Always Delaying Emefiele Trial

By: Esther Ayoola Justice Hamza Muazu for Federal High Court, Abuja don fine EFCC N500,000 based on say dem ask for adjournments for di trial of former CBN Governor, Godwin Emefiele. Dem tell di EFCC on Wednesday to call dia last witness, and pay di  fine to Emefiele. Nor be amebo say, EFCC dey prosecute Emefiele for 20-count charge wey include criminal breach of trust, forgery, and collecting money by […]

todayMarch 19, 2026 1

obodo oyinbo

US Intelligence Clear Iran Say Dem Nor Rebuild Nuclear Weapon After US-Israel Attack

By: Esther Ayoola US intelligence don shake table say Iran nor even rebuild dia nuclear machine wey US and Israel destroy last June 2025. Trump ally and US national intelligence director, Tulsi Gabbard, na tuk dis one for her written testimony to Senate intelligence committee on Wednesday for Washington, DC. She explain say afta Operation Midnight Hammer, Iran nuclear plan end and dat Iran nor do any rebuild, reason wey […]

todayMarch 19, 2026 4

obodo oyinbo

Saudi Arabia Clear Iran Say Dem No Go Tolerate Anymore Attack

By: Esther Ayoola Saudi Arabia Foreign Minister Prince Faisal bin Farhan Al Saud don warn Iran on Thursday, for Riyadh say dem no go dey tolerate any more attacks for Saudi Arabia and neighbouring Gulf states. Im yan dis give tori pipo for di Saudi capital, dat Iran don dey attack dem since dem keep quiet nor mean say Saudi Arabia nor get power, dat dem get strong military power, […]

todayMarch 19, 2026 2

Sports

Anthony Joshua Return To Full Training Afta Lagos-Ibadan Car Crash

By: Esther Ayoola Say like dis, Anthony Joshua don start full training again as e dey prepare for him summer comeback, join di team wey dey train Oleksandr Usyk. Di British-Nigerian boxer last fight na December 19, wen e stop Jake Paul for six rounds for Miami. But days later, him life scatter small, as e waka enter big car crash for Lagos-Ibadan Expressway wey kill him padi dem, trainer […]

todayMarch 19, 2026 1

Sports

Lookman Assist Make Atlético Madrid Beat Spurs 7-5 For UCL

By: Esther Ayoola Ademola Lookman give assist as Atlético Madrid qualify for UEFA Champions League quater finals, even though dem lose 3-2 to Tottenham Hotspur for di second leg. Lookman collect ball for counter, cut small for box corner, then pass am to Julian Alvarez wey score make e 1-1. Tottenham first goal na from Randal Kolo Muani, then Xavi Simons score two, one na penalty. Atlético second goal come […]

todayMarch 19, 2026 1

Sports

NFF Dey Drag FIFA Go Appeal Over DR Congo Player Wahala

Nigeria Football Federation don start process to appeal decision wey FIFA disciplinary committee give about dia protest against DR Congo. Dem bin lose di play-off final 4-3 on penalties for Morocco, but later complain say some DR Congo players no suppose play because of how dem take get passport. FIFA committee don reject di protest after many months, say dem no see enough reason to punish DR Congo. Now NFF […]

todayMarch 18, 2026 5

Sports

D’Tigress Lose Last Game To Germany 81–73 For FIBA Qualifiers

Nigeria women basketball team, D’Tigress, don end dia campaign for 2026 FIBA Women’s World Cup Qualifying Tournament with 73–81 loss to Germany for Villeurbanne, France. Germany control di game from start to finish, lead for every quarter and take charge for more than 33 minutes before dem pull clear for last quarter. Nigeria try fight back for second quarter, turn six-point deficit to 31–27 lead with one 10-0 run, as […]

todayMarch 18, 2026 5

Sports

Arsenal Enter Quarter Final As Chelsea Crash Out For Champions League Battle

By: Esther Ayoola Arsenal show strong hand as dem beat Bayer Leverkusen 2-0 to enter quarter-final of UEFA Champions League. Di North London club carry di tie 3-1 on aggregate afta ogbonge  performance for both legs. Eberechi Eze na im open scoring with Korrect fine goal before halftime. Later, Declan Rice add another goal for second half to seal di win. For Chelsea FC side, dem crash out afta Paris […]

todayMarch 18, 2026 9

Sports

Senegal Lose AFCON 2025 By Forfeiture As CAF Hand Morocco 3–0 Victory

By: Esther Ayoola Di Confederation of African Football Appeal Board don rule say Senegal forfeit di AFCON 2025 final, give Morocco 3–0, wining under competition rules article 84. Dem say Senegal break rules during di match, so Morocco protesting na Korrect and dem award di victory to Fédération Royale Marocaine de Football. For di case of Ismaël Saibari, dem reduce im punishment to two-match ban with one suspended, and cancel […]

todayMarch 18, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app