Blog horizontal

Background

Sports

Enekwechi Carry Gold, Make Naija History For Shot Put

By: Yusuf Abuh Naija shot put star, Chukwuebuka Enekwechi, don write im name for history book as e carry gold medal comot for men shot put event for Commonwealth Games. Di 33-year-old bobo scatter ground as e launch better throw of 21.07 metres for im second-to-last chance for Scotstoun Stadium, and na dat one seal di gold for am. Dis na di first time wey Nigeria go ever win gold […]

todayJuly 31, 2026 8

obodo oyinbo

Hamas Agree To Finally Drop Weapons As Gaza Peace Tuk Gada Small Brain

By: Yusuf Abuh Hamas don agree to follow new plan wey go see dem drop dia weapons as part of effort to push Gaza ceasefire and prepare ground for Israeli troops to leave. Di Gaza Board of Peace say di agreement na major step wey go help bring better governance, security, humanitarian support and rebuilding for Gaza people. But some analysts dey warn say implementation no go easy because some […]

todayJuly 31, 2026 7

OBODO NAIJA

NARD Give Federal Government August 10 Deadline, Threaten Nationwide Strike

By: Yusuf Abuh Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don give Federal Gornment till 8:00 a.m. on Monday, August 10, 2026, to fulfil di agreement wey dem sign before, or dem go begin total and indefinite strike for public hospitals across di country. Di doctors tok dis one after dia National Executive Council (NEC) meeting wey hold for Gombe State, say plenty promises wey gornment make never see implementation. Dem […]

todayJuly 31, 2026 8

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Clear Gofnors Im Mind, Stop Building Needless Flyovers

By: Yusuf Abuh Wi Presido Bola Tinubu don tia shirt oh,  say some state govos just dey waste gorment money. Dat dis gofnors just dey build fly over up and down even when di place nor get traffic Baba Seyi tuk tok dis one when im receive Oyo State traditional rulers for Aso Rock Baba say im nor understand wetin dey hapun, dat now state gorment dey pocket beta kpogiri […]

todayJuly 31, 2026 10

south west

Osun SSG Don Regain Freedom After Police Arrest

By: Yusuf Abuh Osun State Police Command don release Secretary to di State Government, Teslim Igbalaiye, after dem arrest am for im house for Osogbo on Wednesday. Imole Campaign Council tuk, tuk person, Pelumi Olajengbesi, announce di release and thank di Inspector General of Police and Osun Police Commissioner for responding to calls make dem free am. Police spokesperson, Abiodun Ojelabi, too confirm say Igbalaiye don regain im freedom. Igbalaiye […]

todayJuly 31, 2026 8

Lagos

LAWMA Lock Shops For Ojuelegba Over Illegal Refuse Dumping

By: Yusuf Abuh Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don cut chain oh, like dis now hand don touch some shops and business places for Tejuosho-Ojuelegba area because say traders dey dump dirty anyhow. Dis one hapun on Thursday after several warnings and repeated failure by di affected traders to obey sanitation rules. LAWMA oga, Dr. Muyiwa Gbadegesin, say di action na to restore clean environment, protect public health and make […]

todayJuly 31, 2026 3

OBODO NAIJA

Keke Union Worker Kpai As Ticket Marras Turn Fight For Taraba

Taraba State Police don grab two suspects after dem allegedly stab one Keke union ticket collector kpai for Angwan Kassa Junction, Jalingo, on Wednesday, as fight over daily union ticket scatter everywhere. Tori be say di union worker stop one Keke rider wey no buy di compulsory ticket, and as argument hot, one person pull knife stab am. Di man later die from di injuries, and fear grip residents and […]

todayJuly 30, 2026 13

OBODO NAIJA

Govo Aiyedatiwa Beg Politicians Make Dem Give Women More Political Positions

Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, don call on politicians across Nigeria make dem give more women chance for political and elective positions. Aiyedatiwa tok dis one on Wednesday during di launch of di 774 Explode Project for Akure, Ondo State capital. E say women dey important to national development and add say im administration dey run government wey include everybody, both men and women. Dis 774 explode project na women […]

todayJuly 30, 2026 10

OBODO NAIJA

Oshiomhole Blast Umahi On Top Bad Federal Roads

Senator wey dey represent Edo North, Adams Oshiomhole, don blast Minister of Works, Dave Umahi, say e dey rush start new road projects while plenty old roads still dey bad condition. Oshiomhole tok dis one for Senate on Wednesday, as e point say road wey connect Edo and some Delta cities still dey poor shape. E say di way Umahi dey share road projects no balance and e fit make […]

todayJuly 30, 2026 13

Lagos

Adedeji Omope Promise More Development For Bariga

Bariga LCDA Chairman, Adedeji Omope, don promise more infrastructure, youth empowerment and social programmes for residents. Omope make di promise as Bariga LCDA celebrate her first anniversary in office on Wednesday. During di celebration, more than 2,000 residents receive bags of rice to help reduce di effect of economic hardship. She thank residents for dia support and say di achievements come through teamwork between government and di pipo.

todayJuly 30, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds