Blog horizontal

Background

OBODO NAIJA

Aisha Buhari Show for Late Husband One-Year Remembrance

Former First Lady Aisha Buhari don attend di one-year remembrance of her husband, former President Muhammadu Buhari, wey hold for Abuja on Monday. Muhammadu Buhari, wey rule Nigeria as President from 2015 reach 2023, die on July 13, 2025, for London at di age of 82 after long illness. Dem later bury am for im hometown, Daura, Katsina State, according to Islamic rites.

todayJuly 13, 2026 20

obodo oyinbo

Heatwave Kpai 2,700 People for England, Wales

By : Jolayemi Olajide Person wey dey naija, and other part nor knw wetin God do for am, say like dis, at least 2,700 pipo kpai for England and Wales because of serious heatwaves wey hapun for May and June. According to research wey dem package for Imperial College London, heat wave don make pipo get igbeke, na so dia body dey red, u knw oyinbo na, e be like […]

todayJuly 13, 2026 11

obodo oyinbo

Federal Gorment Match break say no to WAEC AND NECO Increase Reg Fees

By : Jolayemi Olajide Finally, small air don enter di room as di Federal Ministry of Education announce on Monday say dem go wait, dat dem nor dey increase WAEC and NECO registration fee to 50k. Everywia first blur when mehnmehn wak up on Monday hear say dem don increase WAEC and NECO fee, na so dragging start across di obodo Nigeria. Officials inside Abuja code dis suspension because dem […]

todayJuly 13, 2026 14

Lagos

Lagos Gornment Vow To Continous Demolition Of Shanties Along Badagry Expressway

By: Yusuf Abuh Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, announce on Monday say Lagos State Gornment go continue to scatter all illegal structures dem along di Lagos-Badagry Expressway. Senior man Wahab drop dis informate, say, dem nor allow any kin person con scata work wey dem don dey do for di past three weeks, any illegal structure must go ground, so dat di environment go dey ok […]

todayJuly 13, 2026 13 2

OBODO NAIJA

INEC Open Online Portal For 2026 Voters Card Registration!

By: Jolayemi Olajide The Independent National Electoral Commission, INEC, don reopen open online portal for Abuja make all Naija pipo fit register for their 2026 voter's card from anywhere. Di process na, na for Pipo go just log enter di internet portal fill dia correct details, and di address wey dem put for there na im dem go use deliver the Permanent Voter's Card, PVC, straight to their door. INEC […]

todayJuly 13, 2026 24 4

Lagos

Ashton Hall Hail Nigeria As Favourite African Destination

By: Yusuf Abuh American fitness influencer and content creator Ashton Hall say Nigeria na him favourite destination for Africa after him recent tour of di continent. Hall make di statement during an interview on im Kick account on Sunday after complete im multi-country African trip. E say Lagos, Nigeria feel like “an African version of Miami” because of di culture, food and di way people welcome visitors. Di influencer explain […]

todayJuly 13, 2026 38

Sports

Diego Forlan Take Over Uruguay Coaching Job After Bielsa Kawasaki

By : Yusuf Abuh Uruguay don appoint former striker Diego Forlan as interim coach of dia national team after Marcelo Bielsa comot following di team poor performance for di 2026 FIFA World Cup. Uruguay Football Association announce say Forlan go take charge after di two-time world champions fail to pass group stage. Bielsa tenure end after Uruguay finish third for dia group with just two points behind Spain, Cape Verde […]

todayJuly 13, 2026 13 6

Sport Yarns

Stanley Nwabali Return back to Chippa United for South Africa

By : Yusuf Abuh Super Eagles goalkeeper Stanley Nwabali don return to South African club Chippa United five months after e announce say e dey leave di team. Chippa United konfam say di Nigeria international don come back to Eastern Cape ahead of di new season. Di club say Nwabali experience, leadership and presence go bring more value to their squad. Di goalkeeper transfer plan wey make am leave di […]

todayJuly 13, 2026 12

OBODO NAIJA

Soldiers Scata ISWAP Attack, Kpai Cameraman

By: Yusuf Abuh Troops of Operation Hadin Kai don go kpai plenty ISWAP terrorists after dem stop one attack for Cross Kauwa, Kukawa Local Government Area of Borno State. Military tuk say among di pipo wey die na one ISWAP cameraman, and diam idea tools. According to Acting Military Information Officer, Mohammed Goni, di terrorists try attack di troops position around 10:20 p.m. on July 11, but soldiers resist dem […]

todayJuly 13, 2026 16

Lagos

Lagos Court Sentence 16 Offenders To Jail

By: Yusuf Abuh Lagos wast management pipo  don secure court conviction for 16 environmental offenders wey dem arrest for illegal waste dumping across Lagos. According to reports, Di  offenders appear before Oshodi Special Offences and Mobile Court and each receive four months jail sentence for offences including dumping waste for wrong places and refusing to use approved waste collectors. LAWMA  tuk, tuk, Mukaila Sanusi, konfam, say dem arrest di people […]

todayJuly 13, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds