Blog horizontal

Background

Lagos

FCCPC Seal Ikeja Electric Hq Over Consumer Palava

By: Esther Ayoola See Gobe, for Ikeja Electric as Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) seal dia Headquarters on Thursday say dem deprive a consumer im right. Head of tuk tuk, Kingsley Okotie, yarn tori pipo say, im company nor dey hide and dat dem dey cooperate with regulators to settle di matter. Dem dey run ground with all stakeholders make sure say every directive from FCCPC dem follow […]

todayDecember 12, 2025 7

obodo oyinbo

Britain Economy Fall Again, Labour Dey Press For Growth

By: Esther Ayoola Britain economy don shock again as official data show say e shrink 0.1% for October afta e already fall 0.1% for September. Di office for national statistics release di numbers on Friday, and e dey dash blow to labour government wey dey hope revive economic growth. Analysts bin dey expect say economy go grow 0.1%, but di reality na contraction continue. Di only bright side be say […]

todayDecember 12, 2025 6

National

Rivers Lawmakers Accuse Governor Fubara Say Im Cause Anoda Political War

By: Esther Ayoola Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don chop anoda accuse say e dey sidelined lawmakers, and dat dis one sef go fit spark anoda wahala for state. U sabi say on Wednesday, Fubara talk, say him oga, Nyesom Wike, never still, set meeting between im di govo an di Wike-aligned lawmakers. On Thursday for Port Harcourt, speaker Amaewhule wey dey with 10 lawmakers don respond to di governor […]

todayDecember 12, 2025 6

Lagos

How Argument Over Parking For Lekki End For Tragic Death

By: Esther Ayoola One mortor drive don Kpai Lagos real estate agent, Yinka Agboola, 36 years of age, for Lekki because of motor parking wahala for Royal Pine Estate. Di whole mata start Monday evening when one unknown driver park him motor block road. According to report wey newsmen gather from x on Thursday,  people offer am another space, but di man vex begin dey threaten say, "you know who […]

todayDecember 12, 2025 6

National

Owo Church Attack: Suspects Begin Defend Demselves For Abuja

By: Esther Ayoola Trial for five people wey bi suspect  for di June 5, 2022 terror attack wey sup for St. Francis Catholic Church, Owo, Ondo State, don start again on, on Thursday for Federal High Court, Abuja. One Catholic priest, wey court call “SSA” for security reason, testify from behind screen, talk how di attackers waka enter church, kill over 40 worshippers and injure more than 100 people. Di […]

todayDecember 12, 2025 5

National

First Lady Say, Tinubu Dey Handle Naija Security Palava Wella

By: Esther Ayoola Di First Lady, Senator Oluremi Tinubu,  talk sey wi oga Presido, Bola Tinubu dey work tireless make everywhere for Naija dey safe. She yarn dis one on Thursday after di 2025 Children Christmas Brunch, wey shelle  for State House Banquet Hall, Abuja. Senator Oluremi still talk sey di gorment dey act quick and correct, say dem dey handle security wahala wella, citing,  di recent rescue of school […]

todayDecember 12, 2025 11

National

Bayelsa Deputy Gov Ewhrudjakpo Die After Him Collapse For Office

By: Esther Ayoola Bayelsa State don enter mourning  say Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, collapse for im office and later die for hospital on Thursday. Dem rush am go Federal Medical Centre, Yenagoa, but doctors confirm say im no survive. In reaction, Southern Governors’ Forum chairman, Governor Dapo Abiodun, say di news shock am and describe Ewhrudjakpo’s death as painful.

todayDecember 12, 2025 5

obodo oyinbo

Trump Wan Help Sort Thai-Cambodia Border Fight

By: Esther Ayoola Fight for Thai and Cambodia border don make ‘about 600,000 people comot from dia house, plus at least 20 people don kpai for di mata, According to officials, di wahala na because of border palava wey don dey for long time. US Presido Donald Trump, talk on thursday say, e wan yarn with Thai and Cambodia oga dem, make dem stop di fighting, sey e wan protect […]

todayDecember 12, 2025 4

Sports

Super Eagles Coach Chelle Drop Im Final 28-Man Squad For 2025 AFCON

By: Esther Ayoola Super Eagles coach, Eric Chelle, don announce him final 28-man squad for 2025 Africa Cup of Nations wey go hold for Morocco from December 21, 2025, reach January 18, 2026. Di team get three goalkeepers, eight defenders, eight midfielders, and nine strikers. Big names wey no make di final list include Udinese goalkeeper Maduka Okoye and Wolverhampton striker Tolu Arokodare, but Francis Uzoho and Paul Onuachu don […]

todayDecember 12, 2025 4

National

INEC Show Report Card Say Voter Registration Hit 2.6 Million

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don announce say over 2.6 million Nigerians complete dia voter registration for di first phase of di Continuous Voter Registration wey end on December 10. INEC Chairmo, Prof. Joash Amupitan, talk dis one for Abuja, and im say more than 1.5 million people register online while about 1.1 million do physical capture. Im add say di highest turnout come from Osun, […]

todayDecember 11, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app