Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Trump Praise Tinubu Leadership For Letter

By: Yusuf Abuh United States President Donald Trump don write President Bola Ahmed Tinubu, praising am for wetin e call strong leadership on behalf of Nigerian people. Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tok for statement on Wednesday confirm di letter. According to di statement, Trump commend Tinubu for di way e dey lead Nigeria. Di full details of wetin Trump write for di letter never come out.

todayJuly 23, 2026 17

Sports

Mali, Niger, Burkina Faso Want Host 2032 AFCON Together

By: Yusuf Abuh Mali, Niger and Burkina Faso don begin plan to host di 2032 Africa Cup of Nations (AFCON) together, as di three military-led countries join body under di Alliance of Sahel States. Malian Football Federation tok say dia officials meet Confederation of African Football (CAF) President Patrice Motsepe for New York on Saturday to discuss di joint bid. According to di federation, di meeting na important step to follow CAF rules and continue di process to win di […]

todayJuly 23, 2026 17

obodo oyinbo

Trump Promise Iran Fresh Bombing

By: Yusuf Abuh US President Donald Trump don warn say America go bomb Iranian civil infrastructure any time wey Iran go fire missile, rocket, drone or any weapon at ships wey dey pass Strait of Hormuz. Trump write for im Truth Social page on Wednesday say bridges and power plants, including some wey dey around Tehran, fit become target if any fresh attack happen. Di warning come shortly before Trump travel go one US airbase to receive di remains of […]

todayJuly 23, 2026 19

OBODO NAIJA

South-East Govos Back Tinubu For 2027

By: Yusuf Abuh Imo State Govo Hope Uzodimma don konfamte why all di five South-East govos don agree to support President Bola Tinubu second term bid for 2027. Uzodimma fry mouth after one ogbonge meeting with all five gofnors for Imo state capital on Wednesday. Senior man Uzodinma count say all ogbonge project wey baba Seyi dey do for south east naim be di reason why dem dey support am for 2027.

todayJuly 23, 2026 16

OBODO NAIJA

FG Promise Beta Hajj Terminal For Lagos Airport

By: Yusuf Abuh Federal Government don reassure Nigerians say e go continue to upgrade aviation infrastructure, as work to rehabilitate di Hajj Terminal for Lagos airport don progress well. Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, knack dis tori when im go inspect di upgraded terminal on Wednesday. Keyamo press tuks say di government remain committed to improving airport facilities and giving passengers beta services.

todayJuly 23, 2026 17

Lagos

Police Gbab Three Suspected Cult Boys For Imota

By: Yusuf Abuh Lagos State Police Command don arrest three  suspect say dem be  members of Aiye cult group during intelligence operation for Imota. Inside statement by police tuk, tuk Adebisi Abinbola, Police tok say dem catch Jelili Adeyemo, di one wey dey hold guns, Bisoye Adewale and John Okeafo, and recover one Beretta pistol, one local pistol, seven Dane guns, live cartridges, stun gun, handcuffs, cutlasses and oda dangerous weapons. Police don carry di three suspects go court for […]

todayJuly 23, 2026 18

Health

Ebola Don Kill Nearly 1,000 People for DR Congo

By: Esther Daniel Dis ebola mata wey dey look, pipo dey kpai kpai for congo, Nearly 1,000 pipo naim don kpai from Ebola for Democratic Republic of Congo, Dis na according to di country Health Ministry report card on Wednesday. According to di ministry, , Ebola cases don reach 2,473, while at least 737 patients still dey isolation centres and hospitals for treatment. Health officials say dis outbreak don kill people faster dan any Ebola outbreak before am, even pass […]

todayJuly 22, 2026 24

Sports

CAF Hail Africa Teams for Historic World Cup Performance

By: Esther Daniel CAF President, Dr Patrice Motsepe, don praise di performance of African national teams for FIFA World Cup 2026, say di continent achieve historic success and football for Africa dey grow well. For statement wey CAF release on Wednesday, Motsepe say out of di 10 African countries wey play for di expanded 48-team tournament, nine qualify from di group stage enter Round of 32. According to am, dis na di highest number of African teams wey ever qualify […]

todayJuly 22, 2026 27

National

Fubara Declare Support for Rainbow Coalition, Tinubu

By: Esther Daniel Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don declare support for Rainbow Coalition, di political group wey FCT Minister Nyesom Wike dey lead for Rivers State. Fubara tok dis one during di groundbreaking ceremony for Riven Medical Facility, where e also confirm President Bola Tinubu as im preferred presidential candidate and Kingsley China as im choice for governor for 2027 election. Di governor tell all im supporters make dem vote for every candidate wey dey under di Rainbow Coalition […]

todayJuly 22, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds