Blog masonry

Background

Lagos

Lagos State Govo Sanwo Olu Celebrate Oga Presido At 74

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu hail Bola Ahmed Tinubu as e celebrate im 74th birthday, call am korect leader wey get vision and love for kontri man and woman Sanwo-Olu praise Tinubu, call am patriotic and caring leader wey don help bring growth and development to Nigeria. For statement wey im media aide Gboyega Akosile release, di governor say Tinubu leadership don help renew people trust for government. Im still describe am as strong and experienced politician wey don dedicate […]

todayMarch 29, 2026 13

Lagos

Governor Sanwo-Olu Share Tech Device Give Students To Boost For Lagos Education

By: Esther Ayoola Di Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, like dis don expand im Hope for Digital Education programme by giving smart learning devices and core textbooks to public secondary school students across Lagos. According to statement by tuk tuk of di Lagos State Ministry of Basic and Secondary Education, Elias Olawale, say di programme go boost human capital and educational excellence for di state. Olawale say dis na part of of di govo T.H.E.M.E.S agenda, wey focus on Education […]

todayMarch 27, 2026 35

Lagos

Lagos CP Fatai Declare Say Old Police Doings Don Pass, Ready For Collabo

By: Esther Ayoola Lagos State Commissioner of Police, Fatai Tijani don drop promise say gone are those days wey pipo go dey fear police, say like dis na collabo doings di police dey do. Di new commissioner yan dis on Friday for command headquarters for Lagos ahead of 2026 Police Week wey go start on Monday. According to am, modern policing need cooperation, respect and trust, and na why dem dey use community policing take connect with pipo. Im come […]

todayMarch 27, 2026 22

Lagos

How Lagos Gorment Do Give Away For Families Of Dia Late Civil Servant

By: Esther Ayoola Like dis now, di Lagos State Gornment don begin share N701 million plus to 232 families of public servants wey kpai while working for di gorment. Say na commissioner of finance, Abayomi Oluyomi ni run di parrol, praising Governor Babajide Sanwo-Olu for always putting  workers welfare first. According to report, di Families enter Ikeja on Friday for dia cheque presentation for insurance death benefits, dat some collect up to N15 million.

todayMarch 27, 2026 25

National

Airport Police To Do Salutation For Fallen Heroes

By: Esther Ayoola Di Airport Police Command don arrange body to honor officers wey don kpai on duty for National Police Day 2026, dem title am, “Community Partnership: Building Trust.” Police tuk, tuk for Airport Command, Mohammed Adeola, ni post for X on Friday say di event go hellep public build trust. According to report, di celebration go start Monday, 30th March with cleaning exercise, continue with walkathon, public sensitization, and go end Tuesday, 7th April for Eagle Square, Abuja […]

todayMarch 27, 2026 13

National

Turaki PDP Do Anoda Emergency Meeting For Abuja

Pipos Democratic Pati, under Tanimu Turaki National Working Committee and Adolphus Wabara board of trustees, don hold another emergency meeting for Bauchi govo lodge for Abuja. Turaki say, dem dey open to reconciliation and dat from all indication peace fit return to di parti. Meanwhile, Abdulrahman Mohamed-led caretaker committee wey Nyesom Wike back insist say dem sti wan hold planned national convention for 29 and 30 March. Say di mata na to settle di wahala wey dey affect PDP leadership […]

todayMarch 27, 2026 9

National

NURTW Beg Presido To Recognise Baruwa As Dia Chairmo

By: Esther Ayoola Lawyer wey dey represent Comrade Ibikunle Baruwa, Tolu Babaleye, don call on Presido Bola Tinubu make im put bodi for di wahala wey dey shake National Union of Road Transport Workers, NURTW. Oga Laywer say gornment suppose recognise Baruwa as di real National President since courts don already rule in im favour. Babaleye yarn dis one for Abuja as e stand with Baruwa and im supporters. For di union dem says dem nor understand why one man […]

todayMarch 27, 2026 11

National

32 Governors, 8,450 Delegates Enter Abuja For APC Convention

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu say, im     go join im cabinet members, 32 state govos plus 8,453 delegates for Abuja today and tomorrow for di All Progressives Congress National Convention. Oga Minister of Information, Mohammed Idris, yarn for news tuk, tuk on Thursday. Idris say top party ogas and leaders from national, zonal, state and ward level go dey di convention as dem go elect new party leaders.  

todayMarch 27, 2026 11

National

Former Senate Presido Saraki Insist Say PDP Sti Get Life

By: Esther Ayoola Former Senate Presido, Bukola Saraki, say like dis now, di Pipos Democratic Party (PDP) sti  dey pull crowd wetin nor good and dat di parti nor scata anything. E yarn dis one for TV sit down tuk, say di parti sti get beta grassroot connect. According to am, say na quarrel dey cause di wrong impression, as plenty Nigerians sti dey support di party.

todayMarch 27, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds